Blog sidebar

Background

Sports

Zeki Amdouni Fit Retire From Professional Football Dis Week

Switzerland star, Zeki Amdouni, don yarn say he fit retire from professional football once he face Lionel Messi for FIFA World Cup. He yarn dis one for him Snapchat on Tuesday after Switzerland beat Columbia. Amdouni joke say after di match, he go just end im football career. Argentina wey be defending champions go jam Switzerland for quarter-final later this week.  

todayJuly 8, 2026 24

OBODO NAIJA

 Naija Senate Clear Im State Assemblies Why Dem Need Pass State Police Law

By : Jolayemi Olajide Di National Assembly dontigthen every every as e take concern security for obodo Nigeria, say make all di 36 State Houses of Assembly to quick-quick approve di bill for state police. Dis move follow di efforts wey oga Presido Bola Ahmed Tinubu make to spread policing power to hellep fight jaguda boys Di lawmaker press yans, say true, true, Nigeria need state policing. Senate come commend […]

todayJuly 8, 2026 10

OBODO NAIJA

News House of Representatives scata as lawmakers clash to summon President Tinubu

By : Jolayemi Olajide Di House of Representatives bin turn to warzone on Wednesday after lawmakers quarrel sake of one motion wey dey ask make President Bola Ahmed Tinubu come explain him side for di Green Chamber. Benedict Etanabene wey be lawmaker for Delta State bin raise di issue because of one circular wey di Accountant-General Shamseldeen Ogunjimi send out on June 29. Etanabene argue say di matter too serious […]

todayJuly 8, 2026 8

Sports

Former Eagles captain Ekong confess say Watching World Cup for TV dey pain body

By Oluwatosin Ibrahim Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don drop bumbshell  shame wear am agbada, and caftan as super eagles nor qualify for di world cup. Im yarn dis one during one media tuk, tuk on tuesday for social media post. Ekong explain say normally, Super Eagles na di akpormiemie of any international competition and, as dem nor go dis one, say di world cup nor too sweet.  

todayJuly 8, 2026 44 11

OBODO NAIJA

Wike Camp, Turaki Camp Wait as Court Shift PDP Case 

By Oluwatosin Ibrahim Federal high court judge, Justice Salim Ibrahim don shift judgment for di PDP leadership mata to July 10 to decide who be di authentic leaders of di party between Nyesom Wike camp and di interim National Working Committee wey Tanimu Turaki lead. Di court also move hearing for appeal wey ADC, Accord and three oda political parties file against dia deregistration go July 14. Senator Adolphus Wabara […]

todayJuly 8, 2026 11 2

south west

Ondo Police kpai 2 Jaguda kidnapers

Ondo State police command don do small kpachiaon rascal some jaguda boys kpai  two suspected kidnappers for  Akure–Owo Expressway, Akure North Local Government Area of di state Command tuk tuk person, DSP Abayomi Jimoh, naim konfamate dis mata for statement on Wednesday give tori pipo, say na major breakthrough against jaguda boys. Di senior man police tuk tuk explain sya na based on betalicious inteliigent informate dem take operate on […]

todayJuly 8, 2026 10 2

Sports

Messi Score As Argentina Survive Egypt Scare

By: Yusuf Abuh Argentina fight back from two goals down to beat Egypt 3-2 for Atlanta and qualify for di World Cup quarter-final. Yasser Ibrahim and Mostafa Ziko bin give Egypt 2-0 lead, even as Lionel Messi miss penalty after goalkeeper save am, before Cristian Romero start di comeback with header. Messi later score di equaliser to make am nine straight games wey im don score for World Cup matches […]

todayJuly 8, 2026 14 1

obodo oyinbo

US Forces Launch Heavy Strike Inside Iran

By: Yusuf Abuh US military don launch heavy air strikes inside Iran on Tuesday after Iran forces attack three merchant ships for inside di Strait of Hormuz. US Central Command tuk for X (Twitter) konfam say hand really touch Iran oh, nor be small. Di US military dey vex say wetin Iran do pass line, e dey dangerous, and e break di ceasefire agreement wey start since April 8. Dis […]

todayJuly 8, 2026 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Pick Squad To Create Laws For State Police  

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don launch ogbonge special quad  wey dem dey call Presidential Working Group on di National Policing Bill, to map di way for Naija state police Na Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, stand in for di Presido to open di committee group for inside di Presidential Villa for Abuja. Dis move dey happen after di National Assembly pass di new law […]

todayJuly 8, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds