Blog sidebar

Background

Sports

Scholes Want Ancelotti For Man United

Mancester United Legend, Paul Scholes don identify perfect manager, say im want Manchester United to sign Carlo Ancelotti. Since Michael Carrick take over from Ruben Amorim, e never lose match and don carry di team reach third position for Premier League table, pass Aston Villa, Liverpool and Chelsea. For Tv siddon talk, Scholes say e still wan see how Carrick go handle serious wahala and pressure before e fully support […]

todayMarch 3, 2026 5

OBODO NAIJA

Dangote Raise Petrol Price, Pump Fit Hit N1,000 Per Litre

Dangote Petroleum Refinery don raise dia factory price of petrol from N774 to N874 per litre. National Publicity Secretary of di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, Chinedu Ukadike, na im share dis update on Monday. Based on dis, Say petrol fit cost between N980 and over N1,000 per litre for motorists depending on wia dem dey across Nigeria. Ukadike explain say di increase na because of di wahala for […]

todayMarch 3, 2026 4

OBODO NAIJA

DSS Arrest Man Wey Get Connect To Di Attack On Peter Obi For Benin City

Di Department of State Services, DSS don arrest one man, Udeme Monday Stephen, wey dem dey suspect say e plan di attack wey hapun for Benin City, Edo State, against 2023 presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, on February 24. U sabi say, Jaguda boys attack Obi and some ADC chiefs wey bin dey do meeting to welcome former governorship candidate Olumide Akpata join dia party. According to report, […]

todayMarch 3, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Drone Hit UK Base For Cyprus, Germany Warn Say NATO Fit Collect Too

Germany foreign minister Johann Wadephul  say attack fit hit NATO country after Iranian drone go hit British air base for Akrotiri, Cyprus. Im tell tori pipo, say, two oda drones sti try attack but dem  intercept dem. According to report, UK don dey do defensive military work for Middle East against Iran to protect dia forces. Wadephul explain to Deutschlandfunk say Germany soldiers fit defend demself, if dem come under […]

todayMarch 3, 2026 4

Sports

Galatasaray Rest Victor Osimhen For Turkish Cup Match

Say Galatasaray nor go use Victor Osimhen for tonight Turkish Cup match against Alanyaspor, dem say e dey on “active rest.” Other players like Uğurcan Çakır, Davinson Sanchez, Mario Lemina, Roland Sallai, Yunus Akgün, and Mauro Icardi sef no dey di squad because of small injury or special training. U sabi say, Osimhen  score one goal and give one assist for same Alanyaspor game last weekend. Say im go return […]

todayMarch 3, 2026 6

obodo oyinbo

IMN Protest For Lagos Condemn US, Israel Strike

Members of di South-West leadership of di Islamic Movement for Nigeria don hold peaceful protest for Lagos. Dem dey condemn United States and Israel for killing Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei. Dem also talk say im wife, Mansoureh Khojasteh Bagherzadeh, sti kpai from wunjuries wey she suffer for di recent attacks for Tehran, say di waka nor make brain at all. Reports talk say Khamenei sef die on Saturday, […]

todayMarch 3, 2026 4

Lagos

How Lagos Assembly Take Approve LASUSTECH Land Compensation

Lagos State House of Assembly don approve Committee on Rules and Business recommendation wey concern land wahala between Eyingbala family and LASUSTECH, Ikorodu. Majority Leader and Chairman of di Committee, Noheem Adams, tell House yesterday say di Eyingbala pipo na be di original owners of di land wey dey inside LASUSTECH premises, and dat gornment suppose give dem 50 hectares as compensation. Di decision follow long-standing petition wey di family […]

todayMarch 3, 2026 11

Lagos

Governor Sanwo-Olu Promise Package For State Retirees

Governor Babajide Sanwo-Olu say Lagos State gornment go continue to respect retirees and treat dem with dignity, fairness, and equality. Im tuk dis one during a courtesy visit by PTAD Executive Secretary, Tolulope Odunaiya, for Lagos House, Marina. Sanwo-Olu also explain oh, say dem don do reforms for pension system to reflect di reality of today so dat retirees go benefit wella. E add say, im gornment dey serious to […]

todayMarch 3, 2026 6

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Direct Private Sector To Package Naija Gas infrastructure

Wi oga Presido, Bola Tinubu don clear wi Infrastructure Concession Regulatory Commission say make dem run di National Gas Infrastructure Command Centre (NGCC) as Public-Private Partnership (PPP) way, say gorment nor wan put serious money for di project. DG of di commission, Dr Jobson Ewalefoh, na im dey conversate dis mata inside for dia first Project Steering Committee meeting. NGCC na big national plan wey go monitor and manage Nigeria […]

todayMarch 2, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app