Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Army Chief To Employ AI

By: Yusuf Abuh Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, don call on Nigeria say time don reach for us to use artificial intelligence (AI) and other new technology take fight di insecurity gbeges  for di country. E tok dis one during Nigerian Army Day Celebration lecture for Port Harcourt, say insecurity don pass terrorism and banditry enter cyber attacks, organised crime and other tech-driven threats. Shaibu say di […]

todayJuly 6, 2026 9

OBODO NAIJA

Reps Beg Tinubu To Hold On NYSC Reform

By: Yusuf Abuh One house of Rep member from Benue, Philip Agbese don beg wi oga Presido, Bola Tinubu, make im match break for  di proposed NYSC reform until beta eyes look di mata wella. Di lawmaker wey be number 2 tuk-tuk person, yan dis one on Sunday, say even though dem need to modernise di scheme, e no suppose spoil di main aim wey be to unite Nigerians. U […]

todayJuly 6, 2026 12

south west

Oyebanji Vow To Fight Kidnappers After Victims Regain Freedom

By: Yusuf Abuh Ekiti State Governor Biodun Oyebanji don visit di Eda-Oniyo worshippers wey kidnappers release afta dem spend more dan two months for captivity. Di govo see di survivors for Ekiti State University Teaching Hospital, wia dem dey receive treatment, and say sugar wan finish am as im see one small pikin regain consciousness. Oyebanji promise say na di state gornment go pay all di victims' medical bills. E […]

todayJuly 6, 2026 7

Lagos

Lagos Court Give 80-Year-Old Maale Joy Order Gornment To Leave Her Land

By: Yusuf Abuh   One Lagos court, don cut joy soap for one maale, Chief H.A.K. Shonowo, 80-year-old widow, giving her temporary court order wey stop Lagos State Gornment and four oda defendants from taking her land for Lekki Peninsula Scheme I. Justice E.O. Ashade for Lagos High Court, Yaba, give di order pending when di court go hear di  main application for the case. Madam Shonowo, wey dey sue […]

todayJuly 6, 2026 15

Sports

Cape Verde Ready For Messi And Argentina World Cup War

Today, Africa world cup new comers,  Cabo Verde don rake full newspaper say dem nor dey fear anything, say dem go follow up defending champions Argentina  for Miami as both teams battle for place in di World Cup last 16. Cabo Verde, wey be di smallest country to ever reach di knockout stage, don surprise many people after dem draw  Spain and qualify ahead of Uruguay and Saudi Arabia. Argentina, […]

todayJuly 3, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Warn US & Israel As 20 Million Pipo Gather For Khamenei Burial

Iran top negotiator don sama warning say, if US and Israel refuse to end di war as dem promise, Iran go change am for dem. Dis warning dey come as over 20 million pipo gada  for Tehran for di burial of former Supreme Leader Ali Khamenei, wey kpai follow im family members since di war start. Iran army commander self done swear say dem must revenge di blood of Ayatollah […]

todayJuly 3, 2026 10

OBODO NAIJA

Court Back David Mark As ADC Leader

Di Federal High Court for Abuja don back David Mark branch as di correct leader of di  opposition party, African Democratic Congress (ADC). Justice Musa Liman throway di case wey one House of Reps member, Leke Abejide, file, according to di court senior man, dem nor get power to put mouth for political party inside house wahala. Former Vice-President Atiku Abubakar don  hail dis judgment,  say di ruling na big […]

todayJuly 3, 2026 12

OBODO NAIJA

… President Tinubu Hail First Lady ‘Iya Alakara’ For Public

Wi oga presido, Bola Tinubu, AKA baba seyi say make dem leave im wife for am oh, First Lady, Senator Oluremi Tinubu, Iya akara and kulikuli, say im love her like dat. Im yarn dis one on  Thursday for di first Presidential Dinner wey shelle for State House Banquet Hall, Abuja. Dis one nor be say na go come oh, baba  Seyi like joke, like joke call im wife as […]

todayJuly 3, 2026 10

Lagos

Lagos Gornment Order Task Force Make Dem Bring Article Shopping Complex

Lagos State Gornment don order make dem demolish Article Shopping Complex for Satellite Town, (nor be only dia) and give traders and building owners for Agric and Coker markets inside Ajeromi-Ifelodun 14 days to carry out structural integrity tests. Officials from Lagos State Building Control Agency (LASBCA) naim go  inspect di markets on Thursday and dem see plenty building wey don weak like old papa teath. Senior man wey dey […]

todayJuly 3, 2026 14

Sports

Spain Tear Austria Apart 3-0 To Enter Last-16

Spain paint Los Angeles red as dem sample sweet football block Austria comot for World Cup inside America on Thursday. Mikel Oyarzabal score two goals and Pedro Porro use header finish di job as di European champions tear Austria apart 3-0 for di round-of-32 knockout match. Big Hollywood stars like Penelope Cruz, Javier Bardem, and singer Rosalía all show up for SoFi Stadium to cheer Spain as dem dominate the […]

todayJuly 3, 2026 10 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds