Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

Trump Tell Hamas To Comot Bodi From Fight

By: Esther Ayoola US President Donald Trump don give clear warning to Hamas say wahala go dey, if Hamas no drop weapon, and sti send SMS Iran say make dem drop dia arrangements of building nuclear programme again. Trump tuk dis one afta meeting Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for tuks about Gaza ceasefire, Iran matter, and Hezbollah issue for Lebanon. He say Israel don try for di ceasefire, but […]

todayDecember 30, 2025 18

Sports

Super Eagles Coachie Release Expo Ahead Uganda Tie

By: Esther Ayoola Super Eagles head coach, Eric Chelle, share expo, say he fit rotate players for Nigeria Group C match against Uganda for AFCON. Chelle tuk dis one on Monday for him pre-match press conference for Fez Stadium, say many players deserve chance and e no wan depend on only one fixed starting eleven. He add say for football tournament, na full squad involvement ni be di koko, not […]

todayDecember 30, 2025 15

National

FG Knock Air Peace CEO Say New Tax No Go Cripple Aviation Industry

By: Esther Ayoola Federal Gonment don reject claim wey Air Peace Chairman and CEO, Allen Onyema, make say new tax regime go cripple aviation industry and make air ticket cost jump. You sabi say, Onyema tuk for TV sitdon tuk Sunday di dangers wey go follow di new tax law for wi aviation. Chairman of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, respond on Monday say Onyema […]

todayDecember 30, 2025 4

National

How NNPCL Take Do Escravos–Lagos Pipeline Afta

By: Esther Ayoola Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) tuk on Monday say dem don fully restore di Escravos–Lagos Pipeline System (ELPS) for Warri, Delta State. According to statement from di company, di pipeline scarra wetin nor good afta unexpected explosion for December 10, 2025, and dem sha run one or two emergency parrol to control di damage. NNPCL explain say dem work with different experts to contain di area, […]

todayDecember 30, 2025 2

Lagos

Lagos Government Promise Better Flood Control For 2026

By: Esther Ayoola Lagos State Government don wire ogbonge new year promise say dem go take flood control and drainage work for 2026, to di next level based on di praise dem get for flooding season for 2025. Special Adviser to Governor on Environment, Olakunle Rotimi, ni share share dis update inside di Annual Zonal Awards of Emergency Flood Abatement Gang and Drainage Enforcement Gang for Alausa, Ikeja. Im say […]

todayDecember 30, 2025 2

foreign

US Don Promise Ukraine 15-Year Security Cover, Zelenskyy Yarn

By: Rilwan Agbomeji US offer Ukraine 15-year security guarantee as part of peace plan, Ukrainian President Zelenskyy talk on Monday. Zelenskyy yarn say e go prefer make di guarantee last 50 years to stop Russia from any further attack. US President Donald Trump host am for Florida on Sunday, talk say Ukraine and Russia dey closer to peace than before. Negotiations still dey, with wahala like who go withdraw where […]

todayDecember 29, 2025 6

National

Presido Tinubu Cancel Part Of NNPC Debt Worth $1.42bn And N5.57tn

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido, Bola Tinubu don to cancel big part of debt wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) dey owe Federation Account. Dis na according to  Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission talk for report wey dem present at November 18, 2025, Federation Account Allocation Committee (FAAC) meeting. Di report show say the cancellation go wipe about $1.42 billion and N5.57 trillion afta both NNPC and Federation Account […]

todayDecember 29, 2025 8

Sports

Cristiano Ronaldo Vow Say E Go Win More Trophies, Chase 1,000 Goals

By: Rilwan Agbomeji Football superstar Cristiano Ronaldo don vow for ground, say e wan win more trophies and reach 1,000 career goals before im retire finally. Ronaldo yarn dis one for Globe Soccer Awards wey hold for Dubai on Sunday, say e still get passion to play no matter where e dey,Europe or Middle East. E add say e go reach the 1,000 goals target if wunjury no worry am.

todayDecember 29, 2025 13

foreign

Trump To Meet Netanyahu For Florida To Align Gaza Ceasefire Talks

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump wan enter meeting with Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for Mar-a-Lago, Florida, today, to popori one or two on how dem go take address di Gaza ceasefire. Dis meeting come as US dey push Trump 20-point peace plan, even as Israel dey break di peace agreement almost every day. Meanwhile, Israel don increase attacks for West Bank, Lebanon and Syria, and some officials […]

todayDecember 29, 2025 10

Lagos

Lagos APC Go Start E-Registration For 20 Local Government Areas

By: Rilwan Agbomeji Lagos State APC don announce say dem go start electronic registration and revalidation for party members across di state. Di e-registration exercise go run from January 5 reach January 28, 2026 for all 20 local govment areas of Lagos. APC Lagos Chairman, Pastor Cornelius Ojelabi, talk dis one for end-of-year briefing with journalists for Lagos. E talk say di move dey meant to strengthen di party structure […]

todayDecember 29, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app