Blog sidebar

Background

Lagos

AIG Jimoh Show New Police Doings, Say Dem Wan Guide Lagos

By: Esther Ayoola Senior man, Assistant Inspector General of Police wey dey head Zone 2 Command Headquarters Lagos, baba Olohundare Jimoh, say like dis don micro soft word on how dem wan take improve security work and make policing beta for Lagos and Ogun states. Jimoh yarn dis one on Monday during courtesy visit to Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, for Lagos House, Alausa Ikeja, alongside Lagos Commissioner of Police, […]

todayMay 12, 2026 8

obodo oyinbo

Pakistan Suicide Bomber Kpai 7 Pipo For North

By: Esther Ayoola On Tuesday say nor be small tin sup for For northwest Pakistan, dat a suicide bomber pack im explosive tools for Marua (keke) kpai, kpai at least 7 pipo and wunjure about 20 others for one checkpoint attack. According to Police, di man na very anyhow man, e first near two traffic officers for di checkpoint before e release di bomb. Senior police officer, Muhammad Sajjad Khan […]

todayMay 12, 2026 12

OBODO NAIJA

Sowore Backs Aisha Yesufu Senate Bid, Say Na Di Only Way To Save Nigeria

By : Jolayemi Olajide Activist and former presidential candidate, Omoyele Sowore don throw im support behind fellow activist Aisha Yesufu for her 2027 FCT senatorial ambition. Sowore talk dis on Monday during one interview with news pipo. According to am, politics na the biggest form of activism to save society, as e say people wey wan change the system must join political participation. Cue in sound

todayMay 12, 2026 11

obodo oyinbo

US Open Tuks on How ISIS Take Shift Base Enter West Africa, Lake Chad

By: Esther Ayoola United States don warn say terrorist groups like ISIS  don dey move dia operations enter West Africa and Lake Chad Basin afta dem drive dem  for Iraq and Syria. For one new counterterrorism strategy document, na US take tuk dis tuk, say places like Naija, Sahel region, Mozambique, Sudan and Somalia don see fresh increase for terrorist attacks. According to di report, ISIS fighters and other jihadist […]

todayMay 12, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Konfam Say US-Iran Ceasefire Dey Weak As Tension Still High

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don konfam say di one-month ceasefire between US and Iran dey shake wetin nor good and dat e dey on “massive life support”. E yarn dis one for im Oval Office on Monday, say even with di ceasefire, di gbege for di middle east don continue. Meanwhile, Iran parliament speaker Mohammad Ghalibaf reply say dia military ready to respond sharply if any attack […]

todayMay 12, 2026 11

OBODO NAIJA

JAC, FG Start Talks After SSANU, NASU Suspend dia Strike

By : Jolayemi Olajide Joint Action Committee wey include Senior Staff Association of Nigerian Universities and Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions wey bin start indefinite strike on April 30, don begin tuk with  Federal Gornment  over dia  renegotiation of 2009 agreement, allowance and welfare issues. On May 11, union leaders announce say dem don suspend di strike after dem receive assurance from gornment renegotiation committee. SSANU National […]

todayMay 12, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Announce Plan Say Im Wan Suspend Fuel Tax As Petrol Price Dey Rise

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don tuk say e go suspend federal gasoline tax as petrol price go higher sake of Iran war. E tuk dis one for White House as im bin dey chest some questions from tori pipo, say di suspension go continue till everybody balance demself. Di tax wey dem wan pause dey around 18.4 cents per gallon for gasoline and 24.4 cents for diesel. […]

todayMay 12, 2026 7

Sport Yarns

How Olise Beat Mbappe Carry French Best Player Abroad Award

By: Esther Ayoola Michael Olise don win award as best French player wey dey play outside France say im play a very strong season for Bayern Munich. E beat players like Rayan Cherki, Hugo Ekitike, Kylian Mbappé and William Saliba to carry di honour. For Germany, Olise na one of Bayern main players and im even lead for best passes for Bundesliga and Champions League. Im finish di season with […]

todayMay 12, 2026 14

Sport Yarns

Dembélé Carry Ligue 1 Best Player Award Again Despite Wunjury

By: Esther Ayoola Ousmane Dembélé don win Ligue 1 Player of the Year for second year straight afta im strong performance for Paris Saint-Germain. Even though wunjury reduce im playing time, e sti help PSG reach French title and Champions League final. Di 28-year-old score 10 goals and give 6 assists for di season wey e play less matches than last year. Na only few players like Zlatan Ibrahimovic don […]

todayMay 12, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds