Blog sidebar

Background

National

Senate Form 7-Man Committee To Arrange Views On Electoral Act Bill

By: Esther Ayoola Wi Senate don form one seven-man committee to gather and arrange all lawmakers’ views on dabiiii Electoral Act Amendment Bill, 2026. According to report, di committee, wey include Senators Adamu Aliero, Aminu Tambuwal, Adams Oshiomhole, Danjuma Goje, Tony Nwoye, and Titus Zam, go submit one final report to Senate by next Tuesday. Di decision  dey drop afta  more than two hours of Senate discussion of di bill […]

todayJanuary 30, 2026 25

National

President Tinubu Drop SMS For Nigerians To Dey United, Courageous

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu in honour of late Chief Samuel Akintola, don drop advice for Nigerians, to always dey courageous, and avoid bitterness and division. Baba Seyi deliver dis message through di Secretary to di Government of di Federation (SGF), Senator George Akume,  wey go represent am,  for di 2026 Samuel Akintola Memorial Lecture wey shelle for University of Ibadan. Tinubu tuk for di lecture […]

todayJanuary 30, 2026 29

National

Govo Aiyedatiwa Share Plans For Joinbodi Development

By: Esther Ayoola Ondo State gorment and dia mehn don dey clear field to celebrate di state 50th anniversary, as Governor Lucky Aiyedatiwa declare pipo cantered development plan. Na for TV sit don tuk for Akure, di govo drop updates about di state Golden Jubilee, dat, dem dey spend money for key projects. Baba Aiyedatiwa say, Ondo gornment dey invest for important things like roads and buildings, town renewal, healthcare, […]

todayJanuary 30, 2026 24

National

First Lady Remi Tinubu Charge Youths As Dem Launch Dream Centre For OAU

By: Esther Ayoola Wife of wi oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don tell Nigerian youths to dream big and work hard to make dia dreams come true. She yarn dis one on Thursday for Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, during di opening of Oluremi Tinubu Dream Centre, one digital library wey  di Ooni of Ife build for her, with hellep from NITDA. According to di First Lady, di centre na big […]

todayJanuary 30, 2026 23

Lagos

Police Carry Lagos Protesters Go Court Over Anti-Demolition Protest

By: Esther Ayoola Lagos State Police command don carry activist Comrade Hassan Taiwo wey dem sabi as Soweto, and Dele Frank go Yaba Magistrate Court over protest wey dem go do against illegal demolition, di protest wey dem carry go Lagos Assembly. According to Prosecutor lawyer, Anthony Ihiehie, di two of dem join hand for di January 28 protest for Alausa and House of Assembly area wey cause wahala, block […]

todayJanuary 30, 2026 28

Lagos

Police Nab Lagos Couple Wey Fake Kidnap

By: Esther Ayoola Di Lagos state police command don go arrest one couple wey call demselves Fred and Goodness afta dem stage dia own kidnap to collect N10 million ransom from family and friends. According to Police source, say dem fake di kidnap for January 7 because di man wan travel  back to US and  as money no dey, so dem make di plan together. Say, na for one school […]

todayJanuary 30, 2026 29

Lagos

UNILAG And UK University Join Bodi Set Up New School Unit For Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola University of Lagos (UNILAG) and University of Birmingham for UK don sign Memorandum of Understanding to set up Transnational Education Unit, inside, UNILAG. Dis agreement go make dem work with Nigeria Ministry of Education to prepare plans, with aim to start teaching students by 2027. According to report, di courses go include Applied Intelligence, Digital Communication and Media, health sciences and engineering. Education Minister, Dr Tunji Alausa, […]

todayJanuary 30, 2026 24

Sports

Wilfred Ndidi Pay Emotional Tribute Giv Im Late Papa

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, Wilfred Ndidi, don pay emotional tribute to im papa, Mr Sunday Ndidi wey tragically die yesterday afta one car run am for Umunede, near Agbor for Delta State. Ndidi Turkish Super Lig club, Besiktas, don announce say senior Ndidi don die for dia X handle yesterday, and dem still send condolence to di retired soldier. Di Super Eagles Captain for emotional post for im […]

todayJanuary 29, 2026 38

Konfam Mornin Jollof

Know your Right- How to Use Freedom of Information (FOI) Act Take Get Government Information

Freedom of Information (FOI) Act give Nigerians right to ask and collect information from government offices. For dis video, we go explain how you fit use di FOI Act, which government bodies e cover, and di correct way to submit your request. Dis na important knowledge wey every Nigerian citizen suppose get to hold government accountable.   Watch full video for YouTube!

todayJanuary 29, 2026 98 34 3

Konfam Mornin Jollof

Bodi Mata – Waist Pain: How E Dey Affect Your Body and How You Fit Reduce Am

If waist pain dey slow you down, dis video na for you. We go break am down how waist pain dey affect your daily life like work, movement, and rest. You go also learn simple and realistic ways wey fit help reduce the pain make your body dey feel better. No stress, no complicated talk – na clear explanation and correct tips wey you fit start to use immediately.   […]

todayJanuary 29, 2026 102 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds