By: Esther Ayoola
Wife of wi oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don tell Nigerian youths to dream big and work hard to make dia dreams come true.
She yarn dis one on Thursday for Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, during di opening of Oluremi Tinubu Dream Centre, one digital library wey  di Ooni of Ife build for her, with hellep from NITDA.
According to di First Lady, di centre na big step for her mission to hellep young pipo reach dia purpose for life.