Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

13 Kpai For China Highway Crash

By: Esther Ayoola At least 13 people don die and 3 others injure after minibus jam truck for highway accident wey happen for Henan province, central China, early Thursday morning. China traffic police tok say di crash happen for G40 expressway near Nanyang city, as di bus carry 16 people instead of 9 wey am suppose carry. According to di police, di bus jam truck for di major road wey […]

todayMay 28, 2026 10

south west

Police Pour 2,500 Men Enter Ojude Oba Festival For Ogun

By: Esther Ayoola Ogun Police don spread more than 2,500 officers for Ijebu Ode and nearby areas ahead of 2026 Ojude Oba festival wey go happen Friday. Police spokesperson, DSP Oluseyi Babaseyi, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday. According to am, di officers come from different units like Mobile Police, SWAT, Anti-Kidnapping Squad and Force Intelligence Department. Police say dem put di security arrangement to keep […]

todayMay 28, 2026 13

obodo oyinbo

Fire For Kenya Girls School Dorm Kill 16

By: Esther Ayoola Fire wey catch girls dormitory for Utumishi Girls Academy for Nakuru County, Kenya, don kill at least 16 people while 73 others dey hospital. Police source wey tuk to AFP say di fire start around 1 o’clock early Thursday morning as more than 220 girls bin dey sleep for di hostel. Emergency workers, ambulance people and rescue teams quickly reach di school to help victims and carry […]

todayMay 28, 2026 9

OBODO NAIJA

Federal High Court Go Dey Open Weekend For Election Case Filing

By: Esther Ayoola Federal High Court of Naija don order say all dia registries for every division across di kontri go dey open weekends and public holidays from 10am reach 2pm to collect only pre-election matter papers ahead of 2027 general elections. Chief Registrar of di court, Yahaya Shafa, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday, say dem do am because di time wey law give for […]

todayMay 28, 2026 8

Lagos

Lagos Gorment Review Health Insurance Drug Scheme To Solve Medicine Shortage Wahala

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don begin review of im Drug Access Expansion Programme wey dem dey use improve how pipo under Ilera Eko and Eko Social Health Alliance dey get essential drugs. Dis one sef hapun inside one meeting dia Lagos Chamber of Commerce and Industry, Alausa, Ikeja. According to Permanent Secretary, Dr Emmanuella Zamba, say dis package start since April 2024 based on di way enrollees take […]

todayMay 28, 2026 12

Sport Yarns

FG Approve Big Rebuild For Sports Facilities Across Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment don approve di rebuilding of sports infrastructure projects across obodo Naija. Dis na according to statement by di National Sports Commission oga, Mallam Shehu Dikko say di tin go touch di rearranging gof Abuja stadium and oda stadium across di obodo Naija. Officials say dis projects na part of efforts to boost youth development, revive sports facilities naija go dey export beta talent for […]

todayMay 28, 2026 16 1

National

Atiku Hail Amaechi As im Celebrate Anoda Birthday, Call Am “Brother And Patriot

Former Vice President Atiku Abubakar don send correct birthday hailings to the former Minister of Transportation, Rotimi Amaechi. Inside di message wey im post for im X handle on Wednesday, Atiku call Amaechi "brotherly and fellow patriot" wey get strong heart. He hail Amaechi for the beta work wey package during im time as Rivers State govo and minister. To complete the matter, the former PDP presidential candidate pray make […]

todayMay 27, 2026 15

Lagos

Lagos Speaker Obasa Send Big Hailings To Muslims, Beg For Peace And Unity

Speaker for Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don send big hailings to all Muslims for Lagos and inside Nigeria as dem dey celebrate Eid-el-Kabir. For one statement wey im tuk, tuk person, Dave Agboola, sign on Wednesday, Obasa kongratulate di Muslim Ummah for dis year celebration. Di Speaker say dis festival na time for sacrifice, reflection, and tankfunes, and im kon beg everybody make dem continue to hold […]

todayMay 27, 2026 15

Sport Yarns

Femi Azeez Score Two Goals As Super Eagles Flog Zimbabwe To Enter Unity Cup Final

Millwall forward Femi Azeez shine wetin nor good yesterday for im first match for Naija, as im kpake two goals take help Super Eagles flog Zimbabwe. Di boy sharp like razor blade, im sha  put behind am di pain say im club miss out for Championship play-offs, score first goal inside di first five minutes of di game. Azeez sti come add another goal afta one hour pass, to make […]

todayMay 27, 2026 11

Sport Yarns

American Runner Tell Athletics World Pipo To Beg Amusan Say Dem Doub Her Wrongly

American runner, Kyle Merber, don drop bombshell say all di pipo wey doubt Tobi Amusan world record for 2022 suppose beg di Nigerian girl. Naija star Amusan bin set the 100m hurdles world record for 12.12 seconds during di 2022 World Championships, but big names like Michael Johnson tuk dat time say, na breeze cause am dat time. Dem bin dey complain say track condition, new running shoes, or even […]

todayMay 27, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds