Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Oga Presido Military Salary Increase Scatter Political Space

By: Jolayemi Olajide   Oga Presido Bola Tinubu approval of new salary package for Nigerian Armed Forces don cause mixed reactions from opposition parties as dem argue over di reason behind di move. Social Democratic Party and New Nigeria People’s Party welcome di salary increase during interviews for Abuja on Tuesday, saying better pay go improve soldiers welfare and strengthen national security. But Labour Party and Obidient Movement question di […]

todayAugust 6, 2026 14

Sport Yarns

Real Madrid Splash €140m to Sign Yan Diomande

By : Jolayemi Olajide Real Madrid don complete di signing of 19-year-old Ivory Coast winger Yan Diomande from German club RB Leipzig in deal wey fit reach €140 million, making am one of di most expensive young players ever. Di transfer report on Thursday say Diomande sign seven-year contract after several top European clubs show interest in signing di talented winger. Some major European teams bin dey chase di player […]

todayAugust 6, 2026 13

Lifestyle

Kemi Adeosun Husband Don Die for Lagos

By: Jolayemi Olajide   Anthony Adeosun, husband of former Finance Minister Kemi Adeosun, don die at di age of 62 after e pass away on Wednesday for Lagos State. Di Adeosun family announce di sad news on Thursday through statement wey Reverend C. A. Adeosun release on behalf of di family. According to di statement, Anthony Adeosun die on August 5, 2026, but di family no talk wetin cause im […]

todayAugust 6, 2026 21

OBODO NAIJA

NBA Fire EFCC, Say Dem No Get Power Freeze Osun Account

By: Jolayemi Olajide Nigerian Bar Association, NBA, don tell EFCC say dem no get legal power to just freeze Osun State Government allocation account without first follow court and constitutional process. EFCC bin write First Bank on Wednesday make dem block every withdrawal from di account as dem dey investigate alleged N11 billion fraud wey involve Ecology Fund, Intervention Fund and FAAC money. Di letter wey Assistant Commander Adenike Babalola […]

todayAugust 6, 2026 14

Lagos

Lagos Open New Workshop To Boost LNSA Security Operations

  By : Jolayemi Olajide Lagos State don commission new Lagos State Neighbourhood Safety Agency (LNSA) Technical and Mechanical Workshop for Ijede, Ikorodu, to improve maintenance of patrol vehicles, motorcycles and security equipment. House Committee Chairman on Information Strategy and Security, Hon. Stephen Ogundipe, praise Governor Babajide Sanwo-Olu and LNSA General Manager, Prince Dr. Ifalade Oyekan, say di project go strengthen security operations and improve emergency response. Ogundipe tok say […]

todayAugust 6, 2026 13

Sports

Osimhen Transfer Move Hit Wall As Club Reject €75m Deal

By: Yusuf Abuh Victor Osimhen don reportedly miss chance to move to Spain after one top European club reject offer to sign di Nigerian striker for €75 million. Reports from Spanish football outlet Club Uria say Osimhen representatives take di offer go meet di club through intermediaries few days ago, but dem turn am down because of financial concerns. According to di report, Osimhen ready to take pay cut to […]

todayAugust 6, 2026 22

obodo oyinbo

Russia Embassy Deny Say E Dey Recruit Colombian Fighters for Ukraine War

By: Yusuf Abuh Russia embassy for Colombia don deny allegation say e get hand for network wey dey recruit Colombian mercenaries to fight for Ukraine war. Di embassy tok dis one on Wednesday after Colombian news outlet Noticias Caracol publish investigation on Monday wey claim say Moscow dey use Colombians support dia war against Kyiv. According to di embassy, dem no get any connection with di recruiters wey di report […]

todayAugust 6, 2026 18

OBODO NAIJA

Navy Burst Illegal Refinery, Recover 85,300 Litres of Stolen Crude

By: Yusuf Abuh Nigerian Navy don burst two illegal refinery sites and recover about 85,300 litres of suspected stolen crude oil as dem continue dia fight against crude oil theft for Rivers State. Navy Director of Information, Captain Abiodun Folorunsho, tok dis one on Thursday, say di operation happen for Ogba-Egbema-Ndoni axis under Operation Delta Sentinel. According to am, Navy officers discover and scatter di illegal refining sites plus one […]

todayAugust 6, 2026 33

south west

Atiku Blast EFCC, Say Dem Dey Chook Hand for Osun Election

By: Yusuf Abuh Presidential candidate of African Democratic Congress, Atiku Abubakar, don accuse EFCC say dem dey attack democracy after dem freeze Osun State Gornment statutory allocation account few days before Saturday gofnorship election. Atiku tok dis one on Thursday for Abuja through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, say di timing of di action no pure at all. According to am, no reason […]

todayAugust 6, 2026 18

Lagos

Lagos Gornment Tell Residents For Lekki, Ikorodu, Ajegunle Make Dem Run From Flood Areas

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don tell people wey dey stay for Lekki, Ikorodu, Ajegunle and Isheri OPIC make dem quickly comot go higher ground as heavy rain fit cause anoda serious flood. Environment Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one for TV on Tuesday, say anybody wey dey flood-prone area no suppose wait until water carry property or put life for danger. Di warning follow heavy rainfall wey start […]

todayAugust 6, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds