Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Super Eagles striker, Victor Boniface, show him full ginger as e drop better assist for Werder Bremen 4-0 demolition of Borussia Monchengladbach for Bundesliga match wey happen on Sunday. Di Nigerian international wey just land Bremen from Bayer Leverkusen this summer, enter the match for 75th minute as substitute for Romano Schmid, and sharp sharp, e make impact. Na Boniface supply correct assist wey Njinmah use tear net for 81st minute, score di fourth goal wey finish the job. Early for the match, Gladbach bin shout for penalty as Kevin Diks claim say Coulibaly use hand stop him shot, but replay show say nothing dey there. Not long after, Machino almost score, but Bremen no waste time Samuel Mbangula cut inside and fire rocket shot wey blast post enter, catch keeper Moritz Nicolas off balance.
Dem no stop there. By 26th minute, Bremen don double the lead. Mbangula turn provider this time, pass better ball give Jens Stage for box, and the guy blast am inside left post, 2-0. After 74th minute, Bremen don sure say di three points no go waka. Mbangula still dey disturb, draw foul from Diks inside box, referee blow penalty, and Romano Schmid convert am clean. Na there Boniface enter the show. Just six minutes after, e feed Njinmah again wey bend ball with outside of him right boot enter net, 4-0. Bremen fans dey jubilate, Gladbach fans just dey look like cinema.
Written by: News Editor 1
BUNDESLIGA VICTOR BONIFACE WERDER BREMEN
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025