Entertainment

Carter Efe Vow Say E Go Beat Speed Darlington For Ring

todaySeptember 11, 2026 9

Background
share close

Nigerian content creator Carter Efe don vow say e go beat entertainer Speed Darlington when dem enter ring on October 1, tok say na because Speed dey talk about Burna Boy anyhow.

Carter tok dis one for heated face-off with Speed ahead of dia celebrity boxing fight wey go hold for Federal Palace Hotel, Lagos.

For di face-off, Speed Darlington tell Carter say na beating e go use beat am, as both men dey yarn hot yarnings giv diasef.

Carter fire back, dey ask why Speed dey stay close to bouncer, kon tell am make e face am one-on-one without bouncer, say e wan show am say e still be 24-year-old boy wey no dey fear anybody.

Carter also claim say Speed no fit expose am because na im dey hold pipo secrets, say di main reason wey make am wan beat Speed na because Speed allegedly call Burna Boy gay, add say if nobody stop am now, e fit tok di same thing about Davido.

Carter say e no just wan win di fight, e wan beat Speed reach point wey e go disgrace am, as dia ‘Chaos in di Ring’ boxing fight go happen October 1.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 14


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds