International

174 Results / Page 16 of 20

Background

International

Plenty People Miss, Three Don Die As School Collapse For Indonesia

Plenty people miss, three don die as Islamic school building collapse for Indonesia. Search team rush on Tuesday to rescue at least 38 people wey dem believe say still trapped after di building collapse, authorities talk. Di building fall down on Monday for Indonesia main island, Java, where students dey gather for afternoon prayers, local report talk, based on one witness talk. Families wey dey desperate to hear news of […]

todaySeptember 30, 2025 13

International

UNGA 80: Tinubu No Show Fit Be Strategy – Trump Fit Embarrass Am For Nothing, Ex-NIIA DG Talk

Prof. Akinterinwa, former Director-General of the Nigerian Institute of International Affairs (NIIA), don talk say President Bola Tinubu absence from the 80th United Nations General Assembly (UNGA) for New York fit be strategic move to avoid any unnecessary embarrassment from former US President, Donald Trump. As e dey, Akinterinwa explain say even though Vice President Kashim Shettima represent Nigeria for the summit, him no dey on the same level with […]

todaySeptember 26, 2025 10

International

People waka comot as Netanyahu Deny say Gaza dey Suffer ‘Genocide’ and Hunger for UN Speech

Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, don deny accused say dem dey do “genocide” for Gaza or dey use “starvation” as weapon. He talk this one on Friday for United Nations General Assembly for New York. Netanyahu talk say instead of starving Palestinians, Israel dey even help feed people for the war-torn Gaza. According to am, “People wey dey carry fake story say Israel dey do genocide no better pass those […]

todaySeptember 26, 2025 4

International

Malawi Former Presido Peter Mutharika Win Election At 85!

Peter Mutharika carry 57% of di vote for Malawi election, as e make serious political comeback against Lazarus Chakwera. Malawi former Presido, Peter Mutharika, don win last week election with serious political comeback at age 85. Official result wey electoral commission release show say Mutharika carry 57% of di vote, beat President Lazarus Chakwera, wey be 70 years old, wey manage only 33%. Chakwera talk say e don lose before […]

todaySeptember 25, 2025 20

International

FBI Dey Offer $10,000 Reward for Nigerian Man Wey Don Dey Run Since 2001

The Federal Bureau of Investigation (FBI) don announce $10,000 reward for anybody wey fit give correct information wey go lead to di arrest and conviction of one Nigerian man, Olumide Adebiyi Adediran, wey dem dey find for United States because of plenty fraud-related crimes like bank fraud, identity document fraud, and credit card fraud. According to wetin FBI post for dia website on Wednesday, Adediran, wey be 56 years old, […]

todaySeptember 25, 2025 10

International

Man Wey Shine Laser Pointer For Trump Helicopter Don Chop Charge

US authorities don charge one man wey shine laser pointer for di presidential helicopter as e dey comot White House with President Trump inside, na wetin court paper talk on Monday. Na one Secret Service officer see Jacob Samuel Winkler, 33, as e shine red laser light from sidewalk outside White House fence, point am for Marine One helicopter as e dey take off on Saturday, na wetin affidavit talk. […]

todaySeptember 23, 2025 18

International

United States Don Promise Say Dem Go Block Visa For All Big Corrupt Nigerians

U.S. Mission for Naija don talk am again say dem no dey smile with corruption, warn say big men wey hand dirty fit lose chance to enter America. For one message wey dem drop for X, U.S. Mission for Naija talk say the fight against corruption no get border. “To fight corruption no get limit or boundary. Even if na big man enter corruption matter, we fit still block am […]

todaySeptember 23, 2025 9

International

Peru Don Mark Second Day Of Gbege Anti-government Protest

Plenty anti-government protesters for Peru capital Lima jam street again on Sunday after gbege wey injure like 18 people, police and journalists join body. Di youth wey dey lead, “Generation Z,” carry another big march waka go where President Dina Boluarte dey work for downtown Lima, police come full ground dey guard. Trouble don dey boil for Peru since some months now, as gbege with organized crime and extortion don […]

todaySeptember 22, 2025 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app