Lagos

1136 Results / Page 20 of 127

Background

Lagos

Lagos Gornment Vow To Drag X User Go Court Over Fake Flood Video Wey He Post

By: Esther Daniel Lagos State Gornment don threaten to carry one X user wey people dey call Enugu Loudspeaker go court on Tuesday, after di person post fake video of flood con claim say na Lagos e happen. Oga Tokunbo Wahab, disclose dis one for X, as he talk say di user break di law when e share misleading video wey no even originate from Lagos at all. Wahab warn […]

todayJuly 14, 2026 32

Lagos

Lagos Gornment Arrest Mama Wey Send Her Pikin Go Pour Dirty Inside Gutter

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don arrest one woman, Mrs McCarthy, for No. 56 Adaranijo Street, Pedro inside Shomolu on Monday, after she send her pikin go pour dirty inside covered gutter. Lagos State Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, wey disclose dis arrest on top im official X account, warn say any parent wey dey push their pikin to break environmental laws go face heavy punishment. […]

todayJuly 14, 2026 11

Lagos

Lagos Under Flood Attack As Rainfall Ground Businesses, Movement

By: Yusuf Abuh Heavy rain wey fall for Lagos on Monday scatter business activities as flood cover many areas, make vehicles sink and leave plenty motorists and commuters stranded. According to report, Places like Ikoyi, Lekki, Victoria Island and Oworonshoki suffer serious flooding as water take over major roads and cause heavy traffic. Videos from residents show long line of vehicles wey water swallow for hours, while some pipo waka […]

todayJuly 14, 2026 27

Lagos

Lagos Gornment Vow To Continous Demolition Of Shanties Along Badagry Expressway

By: Yusuf Abuh Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, announce on Monday say Lagos State Gornment go continue to scatter all illegal structures dem along di Lagos-Badagry Expressway. Senior man Wahab drop dis informate, say, dem nor allow any kin person con scata work wey dem don dey do for di past three weeks, any illegal structure must go ground, so dat di environment go dey ok […]

todayJuly 13, 2026 23 2

Lagos

Ashton Hall Hail Nigeria As Favourite African Destination

By: Yusuf Abuh American fitness influencer and content creator Ashton Hall say Nigeria na him favourite destination for Africa after him recent tour of di continent. Hall make di statement during an interview on im Kick account on Sunday after complete im multi-country African trip. E say Lagos, Nigeria feel like “an African version of Miami” because of di culture, food and di way people welcome visitors. Di influencer explain […]

todayJuly 13, 2026 46

Lagos

Lagos Court Sentence 16 Offenders To Jail

By: Yusuf Abuh Lagos wast management pipo  don secure court conviction for 16 environmental offenders wey dem arrest for illegal waste dumping across Lagos. According to reports, Di  offenders appear before Oshodi Special Offences and Mobile Court and each receive four months jail sentence for offences including dumping waste for wrong places and refusing to use approved waste collectors. LAWMA  tuk, tuk, Mukaila Sanusi, konfam, say dem arrest di people […]

todayJuly 13, 2026 22

Lagos

LAWMA Clear Apapa Black Spots

By: Yusuf Abuh Lagos dirty management senor men don begin ogbonge clean-up pikopiko doings clean Apapa area of Lagos to clear illegal waste and improve sanitation. For statement, di agency MD/CEO, Dr Muyiwa Gbadegesin, say many of di dirty spots dey remain because some residents and businesses dey avoid approved waste collection channels to escape payment. Im warn say LAWMA go continue to remove illegal dumps and sanction pipo wey […]

todayJuly 13, 2026 22

Lagos

Lagos Court Sentence Man To Kpai By Hanging

By: Yusuf Abuh Lagos State High Court wey dey sit for Ikeja don sentence Justice Odey to death by hanging after court find am guilty say e kpai 35-year-old woman, Benedict Agara. Court hear say di killing hapun on April 3, 2021, for Jakande Housing Estate, Lagos, during one fight wey involve one woman wey dem identify as Amina. Justice Modupe Nicol-Clay rule say prosecution prove di murder case beyond […]

todayJuly 13, 2026 18

Lagos

How Lagos Flood Carry Six-Year-Old Girl

Edited By Ebi Oboko One Lagos resident , Ademola Oloyede,  cry wetin nor gud explain how flood take  carry im six-year-old daughter, Asabi, during heavy rainfall for Okeleye, Charity area of Lagos State. According to am, di rain start on June 28 and later turn to serious flood wey break church fence before water rush enter dia compound. Oloyede say im dey work when dem call am, but by di […]

todayJuly 12, 2026 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds