Lagos

782 Results / Page 21 of 87

Background

Lagos

Lagos Truck Drivers Protest To Stop Tax Extortion

By: Esther Ayoola Say nor small go slow for Lagos, dat Truck drivers, members of di Nigerian Union of Haulage Truck and Trailer Drivers, on Monday protest say dem nor go gree, task collectors wan kpai dem with tax. Dem say Lagos State Taskforce, Vehicle Inspection Office, and LASTMA dey harass, beat, and extort dem under guise of enforcement. Dis protest sef sup afta one driver, Comrade Prince Ogunkanmi Adekunle, […]

todayFebruary 17, 2026 4

Lagos

Lagos Gorment Set To Release Flying Cameras To Boost Security

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say now, dem wan to dey use surveillance drones to boost security work across di state. Executive Secretary of Lagos State Security Trust Fund, Ayodele Ogunsan, ni dey tuk dis one during press conference to mark him first 100 days for office. According to am, dem dey plan sign agreement with Nigerian Air Force and Naija Police Airwing to support beta aerial monitoring and […]

todayFebruary 17, 2026 11

Lagos

Lagos Assembly Approve Deal For Ogbonge Waste Management

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don approve report wey four-man committee prepare on di deal to hellpe di state gorment proper waste management. Untop sitting on Monday for state house Alausa, di committee tuk say, gornment  go share 4,250 tonnes from di 13,000 tonnes waste wey di state dey generate every day, so other investors fit join di waste management mata. Committee wey Speaker Rt Hon Mudashiru […]

todayFebruary 17, 2026 10

Lagos

Lagos Fire Service Launch Marshal Club, Do Safety Training

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service don launch Fire Marshal Club and carry out Safety Walk to waka town make pipo sabi how to prevent fire and respond in emergency. Say, di awareness waka start from dia headquarters for Alausa, Ikeja, pass Ikeja Fire Station, then return headquarters on Sunday. According to di Controller General, Margaret Adeseye, di way  fire  dey worry Lagos, too much, however cases […]

todayFebruary 16, 2026 7

Lagos

Lagos Gorment Plan Move To Return Monthly Sanitation

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly sanitation exercise fit return to di state cause say di way di state tey dey smell nor be small. Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, tuk dis one afta im inspect Lagos Island on Sunday untop di dirty mata. Wahab tell tori pipo say, di gornment dey do everytin within dia power to bring back di exercise […]

todayFebruary 16, 2026 5

Lagos

Kenya, Ethiopia No Gree Leave Lagos City Marathon Title

By: Rilwan Agbomeji East Africa no wan gree leave throne for Lagos City Marathon as Kenya and Ethiopia scatter everywhere for 2026 edition. Kenya Ezra Kipchumba Kerin blaze di road finish 2 hours, 11 minutes, 55 seconds take carry men title, while Ethiopia Meseret Dinke storm di women race finish 2:37:36 for Eko Atlantic. Rain fall small but race still burst 6:30am from Orca Mall, 42km warriors grind am out […]

todayFebruary 14, 2026 7

Lagos

Lagos Continue Free Health Drive Training To Make Road Safe

By: Esther Ayoola Lagos State Drivers’ Institute for Ikeja don continue dia free health and retraining programme for commercial drivers today, na 2,000 drivers dem wan train before di end. General Manager, Tiamiyu Afusat Abike, rake full newspaper say true, true di drivers dey receive serious coaching to stop wawawa driving for lagos Say, normally Govo Babajide Sanwo-Olu don pay di training fee normally to boost compliance, encourage responsible driving […]

todayFebruary 13, 2026 12 2

Lagos

Lagos Gorment Ginger Area To Keep Lagos Clean

By: Esther Ayoola Lagos State Permanent Secretary and Solicitor General, Hameed Oyenuga, dey cry wetin nor good say Lagos dey smell eh, say Lagos dey smell, all because of pipo just dey troway dirty yangayanga everywhere. E yan dis one for ogbonge two-day retreat wey Lagos State Special Offences Mobile Court hold for Amber Residence, Ikeja. Dem title di retreat “Di Mandate of di Lagos State Special Offences Mobile Court, […]

todayFebruary 13, 2026 9

Lagos

Lagos Tighten Campus Security With Ogbonge Tolls

By: Esther Ayoola Oga Executive Secretary and CEO of Lagos State Security Trust Fund (LSSTF), Dr Ayodele Ogunsan, don wire SMS give gornment, say make dem try to treat campus security for Naija very serious. E yan dis one for Lagos Campus Security and Safety Summit wey hapun for Lagos State University College of Medicine, wia im go give safety boots and motors. Say di summit bring gornment pipo, security […]

todayFebruary 13, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds