Lagos

1136 Results / Page 18 of 127

Background

Lagos

NSCDC Burst Fake School, Rescue 106 Youths For Badagry

By : Jolayemi Olajide NSCDC don burst one alleged fake university wey dey run from one three-bedroom flat for Ilado, Badagry, and rescue 106 youths wey dem allegedly use fake foreign school admission package carry enter trap. Di operation happen early Monday after security people monitor di place for days, as dem arrest di man wey dem say na im own di fake school. According to NSCDC, di suspects dey […]

todayJuly 21, 2026 28

Lagos

 Lagos PDP Deny Tinubu 2027 Endorsement

By : Jolayemi Olajide Lagos State chapter of Peoples Democratic Party, PDP, don deny report wey claim say di party don endorse Presido Bola Tinubu and im administration ahead of di 2027 general election. Di party tok dis one for statement wey im Publicity Secretary, Christopher Odianarewo, release on Tuesday, saying di report na false and Nigerians make dem ignore am. According to PDP, Presido Tinubu no be member of […]

todayJuly 21, 2026 17

Lagos

Fire Burn 17 Shops for Sabo Market Ikorodu

By: Esther Daniel No fewer than 17 shops don burn as fire catch Sabo Market for Ikorodu, Lagos, around 1:10 early Tuesday morning. LASEMA tok say di fire start from one shop and spread go oda shops, na electrical surge na di likely cause of di fire. Emergency workers quickly quench di fire before e spread go oda parts of di market. Goods like provisions, groceries and foodstuffs burn finish, […]

todayJuly 21, 2026 18

Lagos

Lagos Police start stage three of Operation Kòs’àyè

By: Esther Daniel Lagos State Police Command don officially start di third phase of Operation Kòs'àyè, wey mean "No Hiding Place for Criminals," to tighten security across di state. Police tuk, tuk, CSP Abimbola Adbisi, announce di operation on Monday during a briefing wit journalists for di Lagos State Task Force office for Bolade, Oshodi. According to di senior woman, Di operation na based on  di Inspector General of Police, […]

todayJuly 20, 2026 25

Lagos

LSSTF Begin Campaign Against Rising Yahoo Yahoo

By: Esther Daniel Lagos State Security Trust Fund don advise Lagos residents and Nigerians make dem protect dia digital identity as cyber fraud dey increase for di country. Lagos State Coordinator of LSSTF Campaign Against Crime, Cultism and Other Vices, Dr. Oladimeji Moses, yan dis one during one youtube interview  on Saturday. According to am, figures from di National Bureau of Statistics show say more than 119,000 data breaches naim […]

todayJuly 20, 2026 21

Lagos

Army Burst Illegal Bunkering Site For Lagos, Arrest Six

By: Esther Daniel Nigerian Army say troops from 65 Battalion don go gbab  six suspected illegal bunkerers, dat is oil thief thief  as dem dey fetch crude oil form di  site inside  Orile  area of Lagos State. According to the Army, dis one hapiun last week,  the operation hapun after dem receive correct intelligence about  dis oil thief thief. Say During the raid, soldiers recover four drums, including two wey […]

todayJuly 20, 2026 17

Lagos

Two Firefighters Collapse as Fire Burn Ketu-Ikosi Building

Nor be small gbege as Two firefighters  land demsleves for hospital after dem collapse as dem  dey try fight fire wey burn di top floor of a three-storey residential building for Ketu-Ikosi, Lagos. Lagos State Emergency Management Agency tuk, tuk, Olawale Afolabi, konfamate dat dis fire hapun early mormor Sunday for No. 11, Ademola Taiwo Street. According to am, di fire hapun because of electric from prepaid meter inside one […]

todayJuly 20, 2026 71 1

Lagos

Lagos Gornment Release General School Calendar For 2026/2027

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment on Thursday don officially release saka school calendar for di 2026/2027 session to make sure say all public and private primary and secondary schools run package wella together. Di Commissioner for Basic and Secondary Education, Jamiu Tolani Alli-Balogun, announce dis one inside Lagos after di Office of Education Quality Assurance (OEQA) hold big meeting with stakeholders to agree on resumption dates, mid-term breaks, and […]

todayJuly 17, 2026 22 2

Lagos

Lagos Gornment Explain How Heavy Rain Take Wound Lagos Roads

By: Esther Daniel Lagos State Public Works Corporation don beg residents make dem get patience as di long rainy season don cause serious flood and spoil many roads and public facilities for different parts of di state. Di agency tok say di bad roads don make movement hard for motorists, commuters and other residents, but dem dey work round the clock to repair roads and make dem safe for use. […]

todayJuly 17, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds