Lagos

986 Results / Page 19 of 110

Background

Lagos

AIG Jimoh Show New Police Doings, Say Dem Wan Guide Lagos

By: Esther Ayoola Senior man, Assistant Inspector General of Police wey dey head Zone 2 Command Headquarters Lagos, baba Olohundare Jimoh, say like dis don micro soft word on how dem wan take improve security work and make policing beta for Lagos and Ogun states. Jimoh yarn dis one on Monday during courtesy visit to Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, for Lagos House, Alausa Ikeja, alongside Lagos Commissioner of Police, […]

todayMay 12, 2026 17

Lagos

Court Throway Alaba Traders Case, Say Police Get Right To Do Investigation

By: Jolayemi Olajide A Lagos State High Court for Ikeja don throw away case wey two traders for Alaba International Market carry enter court, say Police no break dia fundamental rights. Justice Ismail Ijelu tuk say Nigeria Police Force get di power to invite anybody to come answer question for ongoing investigation. Di traders, Uchechukwu Chukwuma wey people sabi as “Mayor” and Alexander Jonah, bin accuse police say dem dey […]

todayMay 12, 2026 15

Lagos

Lagos Gorment to  Launch Special Driver’s License for Lagosians

By : Jolayemi Olajide Lagos State gornment  say like dis, wan launch dia own driver’s license in collabo with Federal Gornment to improve road safety and order for Lagos traffic. Commissioner for Transportation Oluwaseun Osiyemi naim yarn dis one on Monday inside im ministerial briefing for Alausa, Ikeja. Saying dat,   dem go launch di state-owned license in few weeks. Cue in sound He still add say Federal Executive Council don […]

todayMay 12, 2026 13

Lagos

Lagos NMA Leadership Enter Gear 5, Suspending Dia Chairmo Saheed

By: Esther Ayoola Say like dis, na serious Leadership gbege dey inside Nigerian Medical Association, Lagos chapter, dat different groups dey claim leadership position. Dis one sef start on Monday few days afta national leadership konfam, Dr. Babajide Saheed as chairmo of di Lagos branch. One faction for di Lagos chapter later announce say dem don remove Saheed from office over alleged violation of di association constitution. According to di […]

todayMay 11, 2026 17

Lagos

Lagos Council Beg Residents To Protect Public Property

By: Esther Ayoola Oga Works and Infrastructure Supervisor for Eredo Epe Local Council Development Area, Bayo Opetuga, don call on residents make dem protect public infrastructure for dia communities. Opetuga tuk dis one on Monday during inspection of projects wey di council execute for Eredo Epe area of Lagos State. E explain dat, when pipo protect gornment facilities, e dey always hellep preserve di gorment project stay longer. Di council […]

todayMay 11, 2026 15

Lagos

Lagos Gorment Close Eko Bridge For Repairs, Give Traffic Alert

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don announce emergency closure of di outbound lane of Eko Bridge for Lagos Island. According to Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, through statement wey dem wrap like moimoi, say di closure go start on Tuesday, May 12, 2026, for safety checks and repair work. E con sti add say, inward lane for Lagos Island go sti dey open for motorists to pass. Dem […]

todayMay 11, 2026 12

Lagos

Governor Sanwo-Olu Clear Africa Film Industry Why Dem Need To Join Hand Fight Industry Oles

By: Esther Ayoola Oga govo of Naija number one business State, Babajide Sanwo-Olu, like dis, don wire call to everybody for Africa entertainment industry make dem join hand fight piracy, fight all di oles of creative work. Di Lagos number one man, yarn dis one for di 12th edition of Africa Magic Viewers’ Choice Awards wey selle for Lagos. According to Sanwo-Olu, say, if dem leave all dis Creative oles, […]

todayMay 11, 2026 13

Lagos

Lagos Renewed Hope Group Back Tinubu For Second Term, Support Hamzat For Governor

By: Esther Ayoola One political group wey call demselves, Renewed Hope Network (RHN), Lagos branch, don endorse di number one man of Naija, President Bola Tinubu, to run again for 2027 election. Dem also support Lagos Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, to run for Lagos governorship for 2027. Di group make dis announce for prayer meeting wey dem hold for Tafawa Balewa Square for Lagos Island, wia big political mehns […]

todayMay 11, 2026 12

Lagos

Lagos Police Save Four Kidnap Pikin, Return Dem Giv Dia Families

Lagos State Police don rescue four pikin wey kidnappers carry, and don return dem back give dia families after one patrol operation wey happen for Alafia Bus Terminal, Coker-Orile for Lagos. Dis one dey for inside statement wey Lagos State Police Public Relations Officer, SP Abimbola Adebisi, release on Sunday, say on 8th of May, 2026, around 11:40pm, as police officers dey do routine patrol around Alafia Bus Terminal, Coker-Orile, […]

todayMay 10, 2026 21 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds