Lagos

647 Results / Page 49 of 72

Background

Lagos

Demolition Protest: Police Warn Sowore Make E No Enter Lagos

Di Commissioner of Police for Lagos, Mr Olohundare Jimoh, don warn activist Omoyele Sowore and him people make dem no try mobilise protest over di recent demolitions wey happen for di state. CP Jimoh talk dis one on Monday as e dey address newsmen for Iyana-Oworo area near Third Mainland Bridge. Di police oga talk say dem don deploy plenty officers waka around di city to stop any protest wey […]

todayOctober 28, 2025 14

Lagos

NDLEA Burst Lagos Club, Carry Owner And Him Boys For Drug Wahala

Operatives of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don burst one drug party wey happen for Proxy Night Club, Victoria Island, Lagos, on Saturday night, arrest over 100 people, including di club owner, Mike Eze Nwalie Nwogu aka Pretty Mike. Di NDLEA officers wey don already dey inside di party since 11pm scatter di groove around 3am Sunday morning, after dem get correct intel say na drug party dey […]

todayOctober 27, 2025 10

Lagos

Midnight Demolition Tear Oworonshoki Lagos

Residents of Ojulari, Oworonshoki, Lagos, report say demolition people return late Saturday night to pull down houses for dia community, and dem still dey continue di work reach Sunday morning despite protests and local wahala. Eyewitness yan say two bulldozers dey for di site, while over 50 police officers dey fire teargas for people all through di night. Olarenwaju Segun, one resident, talk say, “We no sleep at all because […]

todayOctober 27, 2025 28

Lagos

Plenty People Dey Trapped As Two-Storey Building Don Collapse For Lagos

Tragedy jam Lagos for early Monday as two-storey building don collapse, plenty people dey trapped under di rubbles. Di incident happen for No. 54, Cole Street, Cemetery Bus Stop, by UBA Bank, Oyingbo, Lagos. Lagos State Fire and Rescue Service (LSFRS) talk say dem receive distress call by 00:20 hours, and rescue teams from Sari Iganmu Fire Station reach di scene sharp sharp by 00:29 hours to start emergency operations. […]

todayOctober 27, 2025 14

Lagos

“Police Warn Sowore And Others Make Dem No Protest Over Lagos Demolitions”

The Lagos State Police Commissioner, Mr Olohundare Jimoh, don warn activist, Omoyele Sowore and others make dem no dey mobilise protest over di recent demolitions wey happen for Lagos. Jimoh talk dis one as e dey yan with journalists for Iyana-Oworo near Third Mainland Bridge on Monday. E yan say police don deploy plenty men across di city to stop any kind demonstration wey fit scatter peace. E talk say […]

todayOctober 27, 2025 15

Lagos

Sanwo-Olu No Go Leave Any Project Half – Lagos Government

Di Lagos State Government don assure Lagosians say Governor Babajide Sanwo-Olu no go leave any project half before him tenure end for 2027. Di Commissioner for Information and Strategy, Mr Gbenga Omotoso, talk dis one on Friday during media chat with journalists. He list some of di major projects wey Sanwo-Olu administration don start,  like di 150-bed Massey Street Children’s Hospital, di Green Rail Line, di Ojo General Hospital and […]

todayOctober 27, 2025 20

Lagos

Lagos Don Ban Cart Pushers Wey Dey Collect Waste

Di Lagos State Goment don put ban for all di cart pushers wey dey collect waste for di state, na wetin Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab yarn. Wahab talk say di state don sign agreement with one company wey go dey turn about 4,000 tons of Lagos daily waste into compost fertilizer, wey go help create wealth for di people. He talk say Lagos don replace di […]

todayOctober 27, 2025 12

Lagos

Speeding Driver Don Die For Lagos Road Crash

One driver wey dem never identify don die after him motor somersault for Iponri Bridge inside Lagos Island on Saturday night. Tori be say di man bin dey drive under di influence of alcohol and overspeed before di accident happen around 11:45 p.m. According to statement from Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) spokesperson, Adebayo Taofiq, di LASTMA night patrol team rush reach di scene and recover di lifeless body […]

todayOctober 27, 2025 13

Lagos

“Gas Explosion Don Rock Lagos Market”

Gas explosion don happen for Orisunmibare Market inside Orile-Iganmu area of Lagos State on Sunday afternoon. Di Lagos State Fire and Rescue Service men rush reach di scene around 2:13 p.m. come contain di fire wey burst out from one gas retail shop wey get plenty cylinders of different sizes. According to di Director of di Lagos State Fire and Rescue Service, Mrs Margaret Adeseye, di quick response from Sari-Iganmu […]

todayOctober 27, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app