Lagos

988 Results / Page 51 of 110

Background

Lagos

Lagos Gorment Set Tools For Lekki-Epe Expressway Construction

By: Esther Ayoola Lagos state gornment don konfamate say dem wan resume work for di 2 and 3 sessions of Lekki-Epe Expressway (from Ajah Bridge to Admiralty) on Sunday, January 25, 2026. Special Adviser to di Lagos State Governor on Infrastructure, Olufemi Daramola, na dey conversate dis update to tori pipo say,  di contractor don  already arrange im tools for ground afta smalle delay for Christmas, new year period. Say […]

todayJanuary 21, 2026 21

Lagos

Ministry Of Solid Mineral Explain Say Lagos Gold Refinery Na Private Project

By: Esther Ayoola Di Ministry of Solid Minerals Development don clear air say no be true tuk, say gornment build gold refinery for Lagos, wey go violate federal character principle. Northern Elders Forum (NEF), through dia tuk tuk, Professor Abubakar Jika Jiddere, yarn on Monday say, di refinery wey dey Lagos dey unfair to North. But di ministry, through Special Assistant on Media to di minister of solid minerals, Segun […]

todayJanuary 21, 2026 26

Lagos

Lagos Gornment Advice Lagosians To Check Before Drinking Water

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don warn residents make dem stop using unsafe water, say e dey dangerous to health and environment. Executive Secretary of Lagos State Water Regulatory Commission, Oluwabukola Adeyemo, tuk dis one for one community meeting with water stakeholders for Epe. She say many water wey Lagos get no dey drinkable, unless dem treat am wella because of salt, dirty substances and heavy metals. Adeyemo warn […]

todayJanuary 21, 2026 26

Lagos

Fire Destroy Building for Computer Village, Ikeja

By: Esther Ayoola Another fire badness don sup again, say One-storey building, wia pipo dey do business ni burn wetin nor good for Computer village Ikaja on Tuesday for Somoye Osundairo Street. Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) sha reach area, explain to tori pipo dat di mata sup around 1:55 a.m. and as dem receive calls na so dem park dia tools, enter area for for rescue According to […]

todayJanuary 20, 2026 27 18

Lagos

One Person Kpai For Bus Askident Ikorodu

By: Esther Ayoola Say, another askident badness hapun for Ikorodu wia busus jam jam demselves igboa On Tuesday For Independence Tunnel Inward Maryland Along Ikorodu Road. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) Report Say Di Askident serious say one person kpai for di mata. According to di LASTMA, dem don tow di motors, while dia Rescue And Recovery Team Dey Manage Traffic And Remove Di scata scata from ground. Di […]

todayJanuary 20, 2026 19

Lagos

Lagos Doctor Land Jail For Giving Fake Report

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment say, one doctor from Lagos don land prison dat, im go give fake medical report to hellep internet personality, Adetoun Onajobi, aka @justadetoun, Say e wan bin save her from police arrest. State Attorney General, Oluwasina Ogungbade, SAN, confirm di tori for statement wey dem share for X. From report, dem dey accuse Adetoun of plenty oppression and di use of bad language online […]

todayJanuary 20, 2026 14 9

Lagos

Sanwo-Olu Knock Residents Wey Risk Life Scoop Fuel For Apapa Bridge

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say, belle nor sweet am dat some residents dey risk dia lives unnecessarily, go scrap fuel, for road because say tanker fall for Liverpool Bridge, Apapa, say, dat kin of doings, nor make brain at all, at all. Di govo tuk with tori pipo for di state capital yesterday dat, gorment  no  dey play with safety of Lagosians life. E  praise di  […]

todayJanuary 20, 2026 25 14

Lagos

Govo Sanwo-Olu Accuse NGOs Say Dem Dey Cash Out From Makoko Demolition

By: Esther Ayoola Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu of Lagos State don send accusation to local and foreign Non Gorment Organizations say, dem dey use di Makoko demolition mata take cash out and dat evidence full ground. Im put dis one for tori tuks with news waka waka dem, say, di state carry out di demolition for di safety of di people, because many houses dey under high-tension cable. Sanwo olu […]

todayJanuary 20, 2026 20

Lagos

Sanwo-Olu Sign ₦4.4 Trillion 2026 Budget For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don on Monday sign ₦4.4 trillion 2026 budget into law for di state. E run di parrol for Conference Room, Lagos House, Alausa Secretariat, Ikeja. Oga Govo say di budget, wey dem call “Budget of Shared Prosperity,” go help improve life for people and support development across Lagos. U sabi says, Di Lagos State House of Assembly bin pass di bill earlier […]

todayJanuary 19, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds