National

1292 Results / Page 103 of 144

Background

National

PDP wahala: 3,000 delegates don set for high-stakes convention

Tension don dey rise inside di two factional camps of di opposition Peoples Democratic Party (PDP) as over 3,000 delegates don ready to storm Ibadan, Oyo State, for dia national elective convention wey go happen on November 15 and 16, 2025. Di wahala dey between di camp of acting National Chairman, Umar Damagum, wey get di backing of PDP Governors Forum, Board of Trustees (BoT), and State Chairmen Forum, and […]

todayNovember 10, 2025 17

National

Bread turn weapon! Police arrest man wey stash pistol for Delta

Police for Delta State don catch one man wey hide locally made Beretta pistol inside loaf of bread for Koka area of di state. Di man, wey carry di bread, don dey for police custody as dem dey investigate whether e be armed robber or gunrunner. Di state police spokesperson, SP Bright Edafe, confirm di tori, say dem arrest di suspect during routine stop-and-search operation for di area. According to […]

todayNovember 10, 2025 15

National

Ex-con Stab Police Officer Over Wife Wahala, Jail Matter

Pandemonium burst for Panseke area of Abeokuta, Ogun State capital, as one ex-convict stab one police officer for forehead early Friday morning. Di tori be say di ex-convict waka enter Panseke on top okada, come try collect AK-47 rifle from one police officer wey dey guard near armoured vehicle for di area. According to eyewitness, di man talk say him wan use di gun shoot another officer wey him accuse […]

todayNovember 10, 2025 13

National

Japanese Companies Dey Struggle To Make Profit For Nigeria — Envoy

The Japanese Ambassador to Nigeria, Suzuki Hideo, don yan say plenty Japanese companies wey dey operate for Nigeria dey struggle to make profit. Hideo talk dis one on Friday for Japan Pavilion during di opening ceremony of di 2025 Lagos International Trade Fair wey dey Tafawa Balewa Square, Lagos. Di ambassador talk say even though di companies dey face economic wahala, dem still dey optimistic about di future of dia […]

todayNovember 10, 2025 20

National

Furniture Makers Dey Gbese As Customers Dey Choose Sofa Covers Pass Build New Ones

Di wahala wey dey for economy don hit furniture lovers, but e dey hit di furniture makers pass. Because di cost to make even small sofa or repair old one don high, plenty people dey prefer buy sofa covers, wey dey leave furniture makers dey groan for lack of patronage. Some people sef dey buy chair fabrics make tailors make di covers for dem instead of buying ready-made ones. Lukeman […]

todayNovember 10, 2025 25

National

Bureau De Change Operators Dey Seek Support To Boost End-Of-Year Forex Inflow

Association of Bureau De Change Operators of Nigeria (ABCON) don call for better support and empowerment of dia members to boost foreign exchange inflows during year-end festive season. ABCON President, Dr Aminu Gwadabe, yan dis during interview on Sunday for Lagos. He talk say BDC operators, wey dey close to retail forex users, fit play big role to stabilise Naira and capture more diaspora inflows. Gwadabe yan say plenty forex […]

todayNovember 10, 2025 17

National

UK Warn: No Travel Go Six Nigerian States Over Rising Insecurity

UK don issue fresh travel warning make people no waka go parts of Nigeria because insecurity dey rise, violent crime, terrorism, and kidnapping dey increase for plenty areas. Dem warn say British nationals make dem dey extra careful, review dia safety plan, and get backup plan. FCDO talk say make people no travel at all go Borno, Yobe, Adamawa, Gombe, Katsina, and Zamfara states because Boko Haram and ISWAP dey […]

todayNovember 10, 2025 61

National

Bandits Kill Elderly Woman We Dem Kidnap Because She Too Weak To Trek Kogi Forest

Suspected bandits don kidnap and k!ll one elderly woman, Mrs Elizabeth Olorunshola, for Ilafin-Isanlu community, Yagba East LGA, Kogi State. Di armed men attack di community on Saturday night, November 8, 2025, abduct di woman along Ilafin-Isanlu road and shot another person. Sources for di community yarn say di bandits shoot Mrs Olorunshola after dem see say she too weak to waka enter di forest go their hideout. Di bodies […]

todayNovember 10, 2025 35

National

Anambra Safe For Christmas, Make Una Come Home – Police Commissioner

Anambra Police Commissioner, Ikioye Orutugu, don assure say Anambra dey safe for Christmas and call on all indigenes make dem return home freely. Orutugu, wey don dey in charge of Anambra Police for nine months now as di 35th CP, talk say di state dey free and peaceful, as di recently successful governorship election show. Him yan say deliberate and proactive policing don make Anambra safe for everybody, and diaspora […]

todayNovember 10, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds