Sports

CAF Force Edo Queens To Replay Extra Time

todayOctober 26, 2026 4

Background
share close

Nigerian champion Edo Queens go fly go Cairo, Egypt today, Monday, as dem get mind to win after CAF cancel their first victory.

Dem go play Ghana team Ampem Darkoa Ladies on Thursday, to complete di  WAFU-B qualifying final wey go decide who go enter di CAF Women’s Champions League.

Di match go start straight from extra time with 2-2 scoreline, after CAF cancel di original match for Burkina Faso where Edo Queens bin win 4-1 on penalty because di referee no let dem play extra time.

Even though Nigeria Football Federation appeal say make dem no punish Edo Queens for referee mistake, CAF throw di appeal bounce, so di two teams must finish di match for pitch.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds