National

1414 Results / Page 120 of 158

Background

National

FEC Don Okay Concession Of Port Harcourt International Airport, Approve Presidential Task Force For ‘Detty December’

FEC don rise from im meeting for Thursday, approve say dem go give Port Harcourt International Airport to private investors make dem manage am beta and improve service delivery. Dem also approve long-awaited contract for engineering infrastructure for Maitama 2 District for FCT, Abuja. Aviation Minister, Festus Keyamo, talk say di concession no go make any aviation worker lose him job, as government still dey protect workers rights while dey […]

todayNovember 7, 2025 22

National

FEC Don Approve ₦43bn For Lagos–Ibadan Expressway, Dem Review Key Highway Contracts Across Nigeria

FEC don approve over ₦43bn for Lagos–Ibadan Expressway Phase II, Section II, plus dem don revise and award new federal highway projects across Nigeria. Works Minister, Dave Umahi, yarn reporters say di fresh approval go cover extra works wey include flyovers, underpasses, ramps, concrete pavement, and adjoining roads wey no dey di earlier phases. Di project wey dem first award five years ago never start, but when Mr. President come, […]

todayNovember 7, 2025 30 48

National

Anambra Don Declare Friday As Work-Free Day For Governorship Election

Di Anambra State government don officially declare Friday, November 7, 2025, as work-free day for all civil servants. Di order take effect immediately and e come just before di important governorship election wey go happen for Saturday, November 8, 2025, for di state. Dis information come out inside one statement wey Head of Service (HOS), Mrs. Theodora Igwegbe, release on Thursday, November 6. Di HOS talk say Governor Chukwuma Soludo […]

todayNovember 7, 2025 27

National

Naija Doctor Talk Say Two Men Fit Don Catch Hiv And Hepatitis B From Woman Wey Dem RaPe For Gunpoint

A Nigerian doctor wey him name na Dr. NJ Williamdon Adims, don reveal say two men fit don contract Hepatitis B and HIV from one woman wey dem rape for gunpoint. Di doctor yarn di matter for him Facebook page on Thursday, November 6, say di v!ctim waka come hospital come report di case, and dem run some test to rule out STIs. As dem check di woman, she test […]

todayNovember 7, 2025 22 23

National

Thousands Don Die in Road Crash – FRSC Talk

Di Federal Road Safety Corps (FRSC) don reveal say 3,915 people don die from 7,715 road crashes wey happen across Nigeria between January and September 2025. Di corps also talk say 24,674 people suffer different levels of injuries. Corps Marshal, Shehu Mohammed, announce dis for National Town Hall Meeting/Ember Months Road Safety Campaign Flag-Off wey happen for Port Harcourt, Rivers State on Thursday with di theme, ‘Take Responsibility for Your […]

todayNovember 7, 2025 15

National

TUC Don Vex, Reject 15% Fuel Import Duty

TUC President, Festus Osifo, don warn say di Federal Government plan to impose 15 per cent import duty on petrol (PMS) fit make life hard pass for Nigerians as fuel prices and inflation don already high. Osifo yarn for Channels TV “TUC Half Hour” say di union dey study di policy and dey consult stakeholders to sabi wetin e go mean. E talk say government claim say di duty go […]

todayNovember 7, 2025 25

National

Oyo State Fire Service Dun Recover The Dead Body Of One 45 Years Old Man From Well

Di Oyo State Fire Services Agency for Iseyin Command don recover di body of one 45-year-old man wey fall inside deep well for Odo-Ogbo, Oja-Agbe area of Iseyin Local Government. Moroof Akinwande, wey be Special Adviser to Governor Seyi Makinde on Fire Reform and also di Chairman of Fire Services Agency, announce di matter for one statement wey him drop for Ibadan on Thursday. According to am, di emergency call […]

todayNovember 7, 2025 20

National

We Don Plant Reforms Wey Make Sense For Energy And Jobs — Presidency

Di Presidency don restate say dem dey committed to improve welfare of Nigerians through reforms under President Bola Tinubu’s Renewed Hope Agenda, wey dey yield positive results. Special Adviser to di President on Energy, Olu Verheijen, yan dis one on Thursday during South-West Citizen-Government Dialogue wey Afenifere and DAWN Commission organise for Akure, under di theme, ‘Seeds of Reform, Fruits of Renewal’. Verheijen talk say more investment, more local industries, […]

todayNovember 7, 2025 12

National

“We Go Defeat Terr0rism” – Tinubu Tell US

President Bola Tinubu don assure United States say him government dey fully committed to defeat terr0rism for Nigeria. Di assurance come on Thursday, November 6, for Abuja, as response to security wahala wey President Donald Trump raise. Tinubu talk say despite political gbege wey dey, him administration go still dey engage dia international partners well-well. Di statement follow the swearing-in of two new Ministers and one positive update from Minister […]

todayNovember 7, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds