National

1427 Results / Page 14 of 159

Background

National

How Governor Alia, SGF Akume Take Argue Over APC 2027 Election Ticket

By: Esther Ayoola Say nor small gbege sup for di peace meeting wey George Akume call for All Progressives Congress pipo for Benue state, dat Governor Hyacinth Alia suppose get automatic ticket mata. But afta di meeting for Makurdi, both sides give different meaning to wetin dem agree, especially about who go get automatic ticket. Oga, Secretary to di Gornment of di Federation, Akume explain to journalists di peace waka […]

todayMay 4, 2026 21

National

Obi, Kwankwaso Join NDC For Abuja, Beg Supporters To Join

By: Esther Ayoola Two of Naija top opposition, Peter Obi and Rabiu Musa Kwankwaso on Sunday like dis don buy waka officially join Naija Democratic Congress (NDC). Party big wigs, including leader Seriake Dickson naim welcome dem for di national secretariat for Abuja on Sunday. Afta di joining, Obi and kwankwaso  fry mouth, telling di gorment of di day to allow multi party system exist.

todayMay 4, 2026 13

National

VP Shettima Tell 2026 Hajj Pilgrims To Package Good Behaviour For Saudi Arabia

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don tell Muslims faithfuls wey wan go 2026 Hajj say make dem represent Naija wella and show good character. Oga Vice presido, tuk dis one on Sunday when e flag off di Hajj airlift for Nnamdi Azikiwe Airport for Abuja. Im say, di Pilgrims be like ambassadors of di country, so dem must behave demselves and follow all di rules for Saudi Arabia. […]

todayMay 4, 2026 19

National

Supreme Court Nullify PDP Ibadan Convention

By: Esther Ayoola Nigeria top court don nullify the national convention wey Pipos Democratic Party hold for Ibadan on November 15 and 16, 2025. Say with dis judgment Tanimu Turaki branch otilor, saying dat di Supreme Court tok say dia appeal no get merit. For di split decision, three justices agree say di group break court order wey Federal High Court give before di convention. Justice Stephen Adah come talk […]

todayApril 30, 2026 20

National

PRP Welcome Ex-LP VP Candidate Baba-Ahmed to Party Fold

By: Esther Ayoola Peoples Redemption Party don officially welcome former Labour Party vice-presidential candidate Hakeem Baba-Ahmed into dia party fold. Di announcement come on Thursday for Abuja, as party National Publicity Secretary Muhammed Ishaq tuk say Baba-Ahmed join na big boost for dia plan to build better and prosperous Naija. According to Ishaq, Baba-Ahmed entry na “new dawn” wey go help strengthen dia push for good governance, better security and […]

todayApril 30, 2026 16

National

Tinubu Promote Odumegwu-Ojukwu, Appoint Enikanolaiye As New Minister

By: Esther Ayoola Bola Tinubu don appoint Bianca Odumegwu-Ojukwu as new Minister of Foreign Affairs, promote am from Minister of State for di same ministry. Di announcement come on Wednesday through statement wey Bayo Onanuga sign for Abuja. According to distatement, di change happen afta Yusuf Tuggar resign from di position to pursue him governorship ambition for 2027 elections. Onanuga sti tuk say President don nominate Sola Enikanolaiye from Kogi […]

todayApril 30, 2026 21

National

FG Declare May 1 Workers Day Public Holiday, Hail Nigerian Workers

By: Esther Ayoola Federal Gornment don declare Friday, May 1, 2026, as public holiday to mark International Workers’ Day. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, announce di holiday and hail Nigerian workers for dia hard work and contribution to di country. E tuk say workers effort dey very important for Naija growth and better development. Gornment sti encourage dem make dem continue to dey patriotic, work well, and stay committed to […]

todayApril 30, 2026 22

National

IGP Disu Say Make Dem Sack, Charge Police Wey Kpai Civilian for Effurun 

By: Esther Ayoola Di Inspector General of Police, Rilwan Olutunji Disu don order make dem sack and prosecute di police officers wey shoot one civilian for Effurun, Delta State. U sabi di internet dey hot dis week as a uniform olokpa go kpai one man by name, Mene Ogidi For press briefing wey hapun for Abuja on Wednesday, di IGP point finger for ASP Nuhu Usman as di main officer […]

todayApril 30, 2026 23

National

Former Foreign Minister, Tuggar Buy N50m APC Governorship Form for Bauchi

By: Esther Ayoola Former Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Maitama Tuggar, don go buy APC N50 million governorship nomination form say im wan contest 2027 election for Bauchi State. According to update by Imran Mohammed, aide to APC National Chairman Nentawe Yilwatda, Tuggar don sign documents as party officials present am di form for party secretariat. Tuggar tuk say im ambition no be to cause division but to strengthen […]

todayApril 29, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds