National

1427 Results / Page 15 of 159

Background

National

Obi Raise Alarm how 60% of Naija Student take Join Yahoo

By: Esther Ayoola Di 2023 presidential candidate of labour, Peter Obi, don raise alarm say Naija dey face serious moral and systemic crisis following claim by EFCC Chairman, Olanipekun Olukoyede, say six out of every ten university students dey involved in internet fraud. Obi post for X, say if di claim na true, e show say problem dey for Damascus, dat, dis one nor be only crime but failure of […]

todayApril 29, 2026 17

National

Court Stop INEC From Following ADC Caretaker Congress

By: Esther Ayoola Federal High Court for Abuja don order Independent National Electoral Commission not to recognise or join any congress wey caretaker leaders of African Democratic Congress dey plan. Judge Joyce Abdulmalik still talk say David Mark and some other big men for the party never still get right run package as party leaders. Dis judgment sef don form part of di wahala inside oposition ADC. Di case na […]

todayApril 29, 2026 24

National

Lawyers Demand Open Trial For Delta Police Officer Wey Go Allegedly Kpai

By: Esther Ayoola Human rights group Avocats, Sans Frontières France (AKA Lawyers Without Borders) Don wire call to wi Federal Gornment and Naija Police Force to ensure transparency and public prosecution over alleged kpai, a 28-year-old criminal suspect, one Mene Ogidi. Di group Country Director, Angela Uwandu-Uzoma-Iwuchukwu, explain, say di incident happen on April 26, 2026 for Effurun, Delta State, where ASP Nuhu Usman allegedly shoot di suspect wey dey […]

todayApril 29, 2026 25

National

Datti Baba-Ahmed Dump Labour Party, Say Im Dey Join PRP

By: Esther Ayoola Labour Party 2023 vice-presidential candidate, Yusuf Datti Baba-Ahmed, don decide say im dey comot Labour party to join Peoples Redemption Party (PRP). E yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday, where e explain say problem wan finish  Labour Party. According to am, di party don shift from wetin dem first stand for, na why e decide to comot.

todayApril 29, 2026 21

National

Senate Push New Law To Raise Police Funding

By: Esther Ayoola Senate don begin consider bill wey go cancel and re-enact Naija Police Trust Fund Act for 2025 to improve how police go dey receive dia  money. Senate Leader, Senator Opeyemi Bamidele, naim lead di tuk, say di bill go change things for di police. Say like dis, di Naija police dey suffer serious lack of funding and e dey affect how dem dey perform. Dem tuk say, […]

todayApril 29, 2026 19

National

Tinubu Celebrate Mike Adenuga @73, Praise Am As Naija Business Heavyweight

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don give beta salutate to senior  businessman and philanthropist Dr Mike Adenuga as im  turn 73 years. Tinubu tuk dis tuk inside one seven paragraph statement, say Adenuga na real man wey sabi, wey don put correct mark for Nigerian business world. E tuk say, through Globacom, Conoil, real estate, banking and oil and gas, Adenuga don show excellence for many sectors. Tinubu wish […]

todayApril 29, 2026 26

National

President Tinubu Do Close Door Meeting Plateau Stakeholders For Abuja

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don go hold one ogbonge closed-door meeting with Plateau State stakeholders for Presidential Villa, Abuja. Tatafo pipo dey suggest say na security mata dem discuss based on wetin happun for palm Sunday for Plateau state. Dem tuk for several hours, but nobody release wetin dem discuss to di public. However, say, dis meeting na follow-up to Tinubu recent visit to […]

todayApril 29, 2026 37

National

Military decide Say Na Senoirmen Dem Wan Recruit Fight Insecurity

By: Esther Ayoola Nigerian Armed Forces don unveil plan to engage retired personnel to help tackle rising violent conflicts through mediation and community peacebuilding for Naija. Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, convasate dis one on Monday for Abuja during flag-off of mediation and conflict resolution training for veterans. Di training wey Retired Members of di Nigerian Armed Forces organise with Mediation Training Institute and Defence Headquarters go teach ex-soldiers […]

todayApril 27, 2026 30

National

Remi Tinubu Launch Food Bank For N’East

By: Esther Ayoola Wi first lady, Oluremi Tinubu don launch National Community Food Bank Programme for Borno State Naija, say di project go hellep fight hunger and malnutrition for di region and Naija at large. She tuk dis one during unveiling of di programme on Monday, explain say na her first assignment for Borno, especially to support children and mothers wey need hellep. Earlier on April 3 for Abuja, Ali […]

todayApril 27, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds