National

1427 Results / Page 13 of 159

Background

National

Senior Man Bank Chairmo Jim Ovia Hang Boot Afta 12 Years

By: Esther Ayoola Unto ogbonge update from banking sector say Chairmo and founder, of Africa biggest bank, Jim Ovia, don retire as e tenure don end. Di announcement come out on Tuesday for dia 35th Annual General Meeting wey sti dey go on, dem confirm am for statement too. Di bank tuk say Ovia comot afta e complete di mandatory 12 years as non-executive director and chairmo, as Central Bank […]

todayMay 5, 2026 13

National

Jonathan Hail Yar’Adua 16 Years After Im Buy Waka Go Di Land Of No Return

By: Jolayemi Olajide Say you nor dey know di value of person until u lose am, and dat na di situation of Nigeria as Former Presido, Goodluck Jonathan pay tribute to late Presido, Umaru Musa Yar’Adua marking 16 years remembrance since e kpai. Jonathan Sukuli dis one for im social media post, dat true, true, Naija dey Miss Yar Adua. Dat Yar’Adua na true servant leader wey sabi as “Gentleman […]

todayMay 5, 2026 24 20

National

How Galadima Dey Beg Atiku Join Di NDC Opposition Party

By: Esther Ayoola As e dey hot say one big member of Naija Democratic Congress (NDC), Buba Galadima, don dey toast former Vice-Presido Atiku Abubakar make e join dia party to hellep push opposition movement for 2027 election. E yarn dis one for TV sit down tuk on Monday, say like dis di NDC dey grow in Status. For Galadima, say if Atiku nor join, pipo fit hold am responsible […]

todayMay 5, 2026 11

National

PDP Pick Turaki Lead Interim NWC, Vow Say Dem Must Field Presidential Candidate

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Parti (PDP) don appoint Kabiru Turaki as chairmo of 13-member interim National Working Committee follow dia leadership quanta and Supreme Court judgment. Dem announce am for 103rd NEC meeting for Abuja with support from Seyi Makinde, say moving on, na di new team go handle party matas for now. For him acceptance speech, Turaki tuk say PDP must bring out presidential candidate by force, whether […]

todayMay 5, 2026 16

National

FG Call For Teamwork To Fight Fake News

By: Esther Ayoola Federal Gornment don call, make media, gornment agencies and other stakeholders to do beta collabo to rasca fake news and di speed of wrong information. Minister of Information, Mohammed Idris, tuk dis one for Abuja during 2026 World Press Freedom Day event wey hapun for Radio House. According to Idris, dis anyhow doings of fake news dey reduce pipo trust for gornment and fit scarra national unity.

todayMay 5, 2026 10

National

Abeokuta Cult Clash Kill One, Police Reject Link To Ake Rally

By: Esther Ayoola For Abeokuta, Ogun State, one suspected cult clash don hapun leading to di death of one man. According to Police tuk, tuk, DSP Oluseyi Babaseyi say di fight hapun for Wasimi Ake Road near Centenary Hall and Lotus Bank, as gunshots burst and di jaguda scata, run enter Ijemo Agbadu area. Oke Itoku Division detectives naim con quickly move enter di scene and like dis don start […]

todayMay 5, 2026 14

National

Strike Shut Down University of Ilorin as SSANU, NASU Demand Beta Pay

By: Esther Ayoola Activities for University of Ilorin don stop as workers begin indefinite strike. Say members of Senior Staff Association of Nigerian Universities and Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions even gather for peaceful protest for school gate on Monday. Dem carry placards dey demand beta salary, payment of withheld wages, and 45 percent increment instead of 30 percent. SSANU chairmo, Falowo Olushola, explain di strike say […]

todayMay 5, 2026 9

National

FG Begin Plans To Bring Citizens Home From South Africa Based On Xenophobia Gbege

By: Esther Ayoola Federal Gornment don start plan to evacuate Nigerians wey dey South Africa, based on xenophobic tension and protest. According to Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu, wey tuk dis mata on Sunday for her X page, baba Seyi don give order for Nigerians Safety first. Say na about 130 Nigerians don already register for voluntary repatriation flights. Dis evacuation dey happen because of rising protest wey pipo dey […]

todayMay 4, 2026 26

National

Police Sack ASP Nuhu Usman, 4 Others Over Di Killing Of Mene Ogidi

By: Esther Ayoola Di Naija Police force don sack ASP Nuhu Usman and four other officers wey illegal kpai one suspect for Effurun, Delta State. Nor be Amebo again say, police kpai 28-year-old, Mene Ogidi for Warri, and di tin cause serious anger online. Police tuk, tuk, DCP Anthony Placid, naim give dis announcement on Sunday, say dem go sti charge di officers to court for di mata.

todayMay 4, 2026 48

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds