National

1427 Results / Page 4 of 159

Background

National

Former Delta State Govo, Okowa Beg EFCC For Im International Passport

By: Esther Ayoola Former Delta State govo, Ifeanyi Okowa, don reportedly waka go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) office for Lagos to request for im international passport wey dem seize. According to aproko pipo inside di agency tuk say di visit na part of discussion to allow am collect di travel document so e fit travel go abroad for medical treatment. Di former govo bin get mata with di […]

todayJune 23, 2026 12

National

Tinubu Appoint New NUC Board Chairmo

By: Yusuf Abuh   Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint Professor Oluwatoyin Ogundipe as di new Chairmo of di governing board of National Universities Commission, NUC. Ogundipe dey take over from emeritus professor Olufemi Aina, wey resign from di position less dan one year afta im appointment. Baba Seyi bin appoint Aina for July 2025 and dem inaugurate di board members for November 2025. Ogundipe, wey serve as […]

todayJune 23, 2026 10

National

Labour Unions Para for N70k Minimum Wage

Nigerian labour unions don tell Federal Government say N70,000 minimum wage no reach anywia again because food, transport, and house rent don cost gan. Inside one meeting for Geneva, di unions tuk say dem no go gree make gornment tax dis money or put more load for poor workers body. As di two-year review time dey reach for July 2026, labor leaders dey plan to start tuk sharply with gornment […]

todayJune 17, 2026 15

National

FG Deny Cyberattack On Education Data Platform

By: Esther Ayoola Federal Ministry of Education don deny reports wey claim say hackers attack di Naija Education Management Information System, NEMIS. For statement wey dem release on Tuesday, Director, wey bi di tuk tuk person, Folasade Boriowo, dey make mouth oh, say, dem nor born any jaguda boy to attack dia platform. According to di ministry, all information for NEMIS, sti safe, secure and fully protected.

todayJune 16, 2026 14

National

Late General Rabe Family Kwanta with Kastina State Gorment

Con see problem oh, as pikin of late Major General, Rabe Abubakar (rtd), Isyaka Rabe,  don reject claim wey Katsina State Gornment tuk say im papa die from diabetes and hypertension. Im talk dis one for interview with news pipo, say kastina state gorment report nor correct, as im papa no get history of diabetes. Isyaka add say some pipo dey even tuk say na snake bite or heart attack, […]

todayJune 15, 2026 20 2

National

Umahi Defend FG Roads, Tinubu Highways Go Boost Economy

Minister of Works, David Umahi, don defend Federal Government road project spending, say President Bola Tinubu four legacy highways na important economic corridors. Im talk dis one during Renewed Hope Media Tour for Ndi-Egbe Bridge site for Afikpo, Ebonyi State, wey link Ebonyi to Cross River State. Umahi still talk say dem dey build wetin fit be di longest flyover for Africa near Dangote Refinery axis of Lagos-Calabar Coastal Highway […]

todayJune 15, 2026 17

National

IGP Disu Promote 374 Kwara Police Officers

By: Shalom Ovie IGP Olatunji Disu promote 374 police officers for Kwara State Command say make dem go rake out jaguda boys. Police tuk, tuk, Adetoun Ejire-Adeyemi, naim announce di promotion for Friday as part of nationwide exercise. According to am, 365 constables, two corporals, five sergeants and two superintendents benefit from di promotion. Police say di exercise na to reward officers wey dey work hard and serve well.  

todayJune 12, 2026 19

National

Tinubu Change Kaduna School name to Shehu Musa Yar’Adua

By : Shalom Ovie Wi oga Presido, Bola Tinubu don rename di Institute of Petroleum Studies for Kaduna to General Shehu Musa Yar’Adua University of Geological Sciences and Engineering Technology. E make di announcement on Friday during im Democracy Day speech for Nigeria. Tinubu tuk say di move na to honour di late Shehu Musa Yar’Adua for im contribution to Nigeria democracy journey.    

todayJune 12, 2026 17

National

Reps Approve Major Constitution Reform Bills

By: Shalom Ovie House of Representatives don advance Constitution amendment bills wey go bring major reforms for Nigeria governance system. Tuk, tuk person Akintunde Rotimi naim sorosoke di bills, after months of work and input from lawmakers, institutions and citizens across di country. Di process include public hearings and consultations for all six geopolitical zones. Di bills cover areas like elections, judiciary, security, local government and human rights reforms.  

todayJune 11, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds