By: Esther Daniel
2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don repeat say if Nigerians elect am as Presido, e go serve only one term because four years dey enough to put Nigeria for di right path.
Obi tok during one siddon tuk interview say im one-term promise no be campaign strategy, adding say e and im running mate, Rabiu Kwankwaso, agree on di arrangement based on trust.
According to am, e no need more than four years to show Nigerians di right direction, and e ready to sign any agreement to prove say e go keep im word.
Di former Anambra State governor also tok say as governor, e fulfilled many of di promises wey e make during campaign, and say leaders must learn to keep dia promises.