National

1427 Results / Page 2 of 159

Background

National

FG Say Money No Go Stop Qualified Students From School

By: Esther Daniel Federal Gornment don assure Nigerians say no qualified student go miss higher education because of money wahala, as dem say reforms don remove financial barriers. Education Minister, Dr. Tunji Alausa, talk dis during meeting with education stakeholders, saying government don invest over one trillion naira in universities, polytechnics and colleges of education. Alausa say presido Tinubu administration dey focus on helping young Nigerians get better education no […]

todayJuly 28, 2026 16

National

Oga Presido Tinubu Vow Justice As Gunmen Kill 30 People For Kaduna

By: Esther Daniel Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh say make wi security look for way go gbab di jaguda boys wey go kpai about 30 innocent residents for Naridon Village, Kauru Local Government Area of Kaduna State. Special Adviser Bayo Onanuga wrap dis one for message on Tuesday, dat di gun scarra di community for hours, no going, no coming. Di dangerous attackers kpai kpai mostly […]

todayJuly 28, 2026 9

National

Peter Obi Question Borrowing, Say Nigerians Never See Improvement

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don question di current administration over increased borrowing despite saying subsidy payment don stop. Obi tok say even though Gornment dey generate more revenue from different sources and no longer dey pay fuel subsidy, di country don still borrow pass when subsidy dey. According to am, ordinary Nigerians never see any visible improvement for dia daily […]

todayJuly 27, 2026 14 2

National

Peter Obi Repeat Promise, Say Four Years Is Enough To Fix Nigeria

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don repeat say if Nigerians elect am as Presido, e go serve only one term because four years dey enough to put Nigeria for di right path. Obi tok during one siddon tuk interview say im one-term promise no be campaign strategy, adding say e and im running mate, Rabiu Kwankwaso, agree on di arrangement based […]

todayJuly 27, 2026 17 2

National

Fubara Declare Support for Rainbow Coalition, Tinubu

By: Esther Daniel Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don declare support for Rainbow Coalition, di political group wey FCT Minister Nyesom Wike dey lead for Rivers State. Fubara tok dis one during di groundbreaking ceremony for Riven Medical Facility, where e also confirm President Bola Tinubu as im preferred presidential candidate and Kingsley China as im choice for governor for 2027 election. Di governor tell all im supporters make dem […]

todayJuly 22, 2026 11

National

Oluremi Tinubu Promise To Wear Akwete Cloth If Tinubu Win Again

By: Esther Daniel Wife of di Presido, Senator Oluremi Tinubu, don promise say if baba Presido Bola Tinubu win second term for 2027 election, she go dey wear Akwete buba and wrapper. Iya ikulukuli tok dis one on Tuesday during her first visit to Akwete Weaving Cooperative Village for Ukwa East Local Government Area of Abia State, wia she announce ₦2 billion support to help revive di local textile industry. […]

todayJuly 22, 2026 15

National

Police Officers Cast Demsleves Go Collect Bribe Of N53,000 From ICPC Chairmo

By: Esther Daniel Four police officers don land for wahala after dem allegedly collect N53,000 from  Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission,  ICPC Chairmo, Dr Musa Aliyu, during illegal stop-and-search operation for Banex area of Wuse, Abuja. FCT Police Commissioner, Ahmed Sanusi, yarn on Monday say di officers abandon dia official duty posts, mount illegal checkpoint and no know say di man wey dem stop na ICPC oga. […]

todayJuly 20, 2026 19

National

Ghost Agency Budget Mata Strolls Enter National Assembly

By: Esther Daniel Speaker of House of Representatives, Tajudeen Abbas, go today launch one special committee to investigate how dem take put N1.32 billion for Presidential Foreign Investment Promotion Council inside 2026 budget, even though di agency never dey legally. Di committee, wey Honourable Yusuf Gagdi dey lead, go hold public hearing for National Assembly Complex for Abuja. U sabi say, di  investigation start after police arrest Adeyemi Adeniyi, wey […]

todayJuly 20, 2026 13

National

INEC Beg Federal Government Make Dem Increase Money Before 2027 Election

By Esther Daniel Oga Chairmo for wi number one election body, INEC, Prof. Joash Amupitan, SAN, don don bring neck comot say make federal gorment increase dia money for 2027 election. Prof. Amupitan tuk dis one during one courtesy visit to Chairmo  of  wi gorment house pipo wey dey hand money, Dr. Mohammed Bello Shehu, for Abuja. Im say di visit na to strengthen beta working relationship between the two […]

todayJuly 15, 2026 16 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds