National

Oga Presido Tinubu Vow Justice As Gunmen Kill 30 People For Kaduna

todayJuly 28, 2026 4

Background
share close

By: Esther Daniel

Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh say make wi security look for way go gbab di jaguda boys wey go kpai about 30 innocent residents for Naridon Village, Kauru Local Government Area of Kaduna State.

Special Adviser Bayo Onanuga wrap dis one for message on Tuesday, dat di gun scarra di community for hours, no going, no coming.

Di dangerous attackers kpai kpai mostly women and children come set many family houses ablaze during the cowardly night operation.

Tinubu mourn with the families and promise say security agencies go chase down all the terrorists to face full justice.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds