National

1414 Results / Page 3 of 158

Background

National

Late General Rabe Family Kwanta with Kastina State Gorment

Con see problem oh, as pikin of late Major General, Rabe Abubakar (rtd), Isyaka Rabe,  don reject claim wey Katsina State Gornment tuk say im papa die from diabetes and hypertension. Im talk dis one for interview with news pipo, say kastina state gorment report nor correct, as im papa no get history of diabetes. Isyaka add say some pipo dey even tuk say na snake bite or heart attack, […]

todayJune 15, 2026 16 2

National

Umahi Defend FG Roads, Tinubu Highways Go Boost Economy

Minister of Works, David Umahi, don defend Federal Government road project spending, say President Bola Tinubu four legacy highways na important economic corridors. Im talk dis one during Renewed Hope Media Tour for Ndi-Egbe Bridge site for Afikpo, Ebonyi State, wey link Ebonyi to Cross River State. Umahi still talk say dem dey build wetin fit be di longest flyover for Africa near Dangote Refinery axis of Lagos-Calabar Coastal Highway […]

todayJune 15, 2026 13

National

IGP Disu Promote 374 Kwara Police Officers

By: Shalom Ovie IGP Olatunji Disu promote 374 police officers for Kwara State Command say make dem go rake out jaguda boys. Police tuk, tuk, Adetoun Ejire-Adeyemi, naim announce di promotion for Friday as part of nationwide exercise. According to am, 365 constables, two corporals, five sergeants and two superintendents benefit from di promotion. Police say di exercise na to reward officers wey dey work hard and serve well.  

todayJune 12, 2026 14

National

Tinubu Change Kaduna School name to Shehu Musa Yar’Adua

By : Shalom Ovie Wi oga Presido, Bola Tinubu don rename di Institute of Petroleum Studies for Kaduna to General Shehu Musa Yar’Adua University of Geological Sciences and Engineering Technology. E make di announcement on Friday during im Democracy Day speech for Nigeria. Tinubu tuk say di move na to honour di late Shehu Musa Yar’Adua for im contribution to Nigeria democracy journey.    

todayJune 12, 2026 13

National

Reps Approve Major Constitution Reform Bills

By: Shalom Ovie House of Representatives don advance Constitution amendment bills wey go bring major reforms for Nigeria governance system. Tuk, tuk person Akintunde Rotimi naim sorosoke di bills, after months of work and input from lawmakers, institutions and citizens across di country. Di process include public hearings and consultations for all six geopolitical zones. Di bills cover areas like elections, judiciary, security, local government and human rights reforms.  

todayJune 11, 2026 11

National

Abure Point Finger To Obi, Otti Say Na Dem Scata Labour Party

By: Esther Ayoola Former Labour Party Chairman Julius Abure don accuse Peter Obi and Abia State Governor Alex Otti of causing di leadership crisis wey dey shake di party. Abure, wey tuk for TV sit down tuk on Tuesday, say Labour Party dey peaceful until Obi and Otti carry dia problem come, create caretaker committee for Umuahia. According to am, na dat decision scata di party stability and start di […]

todayJune 10, 2026 11

National

SGF Akume Cast Atiku Say Im Join Leaders Weh Push Rotational Presidency

By: Esther Ayoola Secretary to Gornment of Federation (SGF), George Akume, don go cast wi former Vice Presido, Atiku Abubakar, say im na one of di leaders wey support, make dem dey rotate presidency for Naija like barbar chair afta dem cancel June 12, 1993 election. Akume yarn dis one for World Press Conference for Abuja as part of Democracy Day celebration. Im say di annulment of di election wey […]

todayJune 10, 2026 9

National

Shettima Rake Say EFCC Make Foreign Investors Trust Naija More

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido, Kashim Shettima, nor be small tin oh, don rake full newspaper say, na di  strong work by EFCC make Naija name nor loud for money laundry mata. Shettima yarn dis one during di commissioning of EFCC new zonal office for Ado-Ekiti, Ekiti State. He also assure Nigerians say Federal Gornment go continue to strengthen anti-corruption agencies through beta infrastructure, staff welfare, training and operational […]

todayJune 10, 2026 9

National

Kebbi Govo Extend Retirement Age For Doctors, Medical Workers

By: Esther Ayoola Kebbi State Governor Nasir Idris don approve new retirement age for medical and veterinary doctors, as dem now go retire for age 65, instead of di nromal 60. Di decision hapun during Kebbi State Executive Council meeting wey dem hold on Monday for Government House, Birnin Kebbi. Commissioner for Establishment, Pension and Training, Auwal Dogondaji, naim make dis announcement while e dey brief journalists afta di meeting. […]

todayJune 9, 2026 10 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds