National

1100 Results / Page 40 of 123

Background

National

Presido Tinubu Arrange Nepa Man Dr. Mulisiu Oseni As Nerc Chairmo

By: Rilwan Agbomeji Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint  ogbonge  nepa man Dr. Mulisiu Oseni, as new chairman of di Nigerian Electricity Regulatory Commission afta senate confirm di board members for abuja. Dis one mean say,  presido Tinubu don drop Abdullahi Ramat wey im nominate earlier to replace former Chairman, Sanusi Garba. According to presido tuk tuk persin, Bayo Onanuga, di move na to make sure say strong and effective […]

todayDecember 19, 2025 19

National

NNPC Run Emergency Marrs Afta Escravos–Lagos Gas Pipeline Explosion For Delta State

By: Esther Ayoola NNPC Limited omo comeout yarn marras dat say NGIC don start word afta one explosion hit part of Escravos–Lagos Pipeline System for Delta State. Dem say afta inspection, dem don isolate di affected pipeline sections and everywhere dey safe for host communities and environment. Joint team from NNPC, NMDPRA and maintenance contractors don visit di site make dem check wetin happen. NNPC add say dem dey communicate […]

todayDecember 19, 2025 20

National

Fuel Tanker Blow Auchi Road

By: Esther Ayoola Gobe burst for Auchi, Edo State, as one tanker wey explode kpai kpai pipo for di areas. According to police tuk tuk of Edo state, Eno Ikoedem, wey confamate di tori, na Wednesday around 6:30pm for evening na dis gbege sup. People dey ask, who dey involved, how e take happen, and how many pipo dem fit don jam. Once more detail come, u go get am […]

todayDecember 19, 2025 12

National

Oil Regulators Say Dem Wan Hawk Naija Crude Oil For Showglass

By: Esther Ayoola Hear mata, say di presidential nominees for Nigeria petroleum regulatory agencies don go promise wi senate, say dem go make sure local production become number one, di champion for Naija petrol mata, and say import go be only last option to cover supply gap. Based pressure wey dem face for dia screening for senate on Thursday, omo, dem nor know wen dem promise heaven and earth oh, […]

todayDecember 19, 2025 13

National

Oga Presido Tinubu Cut Chain For 9ja Governors

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh, wia dis vex come from sef nor bodi sabi, say mama Remi never rob im head some time, omo jagaban, enter meeting for Abuja for di mata, change am 9ja govos and APC members say make dem support di idea of state police and local government autonomy. Oga presido yanyanpu dis one for di 14th APC National Caucus […]

todayDecember 19, 2025 8

National

Africans No Be Pawn As NAF Men Free For Burkina Faso – Shehu Sani Talk

By: Rilwan Agbomeji Former Kaduna Central Senator, Shehu Sani, don hail di release of 11 Nigerian Air Force men from Burkina Faso. Di release happen afta Burkina Faso military junta led by Ibrahim Traoré free Naija aircraft and personnel. Sani yarn for X say Africans no suppose be pawn for neo-colonialists and imperialists. E also praise Foreign Affairs Minister Yusuf Tuggar diplomatic waka wey make di release happen.

todayDecember 18, 2025 11

National

Kano State Govo Yarn Say E Go Stop Delay For Public Workers Benefits Payment

By: Rilwan Agbomeji Kano State Govo, Abba Yusuf, don yarn say e no go allow public workers suffer delay for their benefits again. Di pledge come Wednesday as e dey pay severance, accommodation, and leave allowance to 1,371 former councillors wey serve between 2021 and 2024. Di payment ceremony hold for Coronation Hall, Government House, Kano, and na di last batch of payment. In total, government don release ₦8.26bn to […]

todayDecember 18, 2025 9

National

NMDPRA, NUPRC Oga Dem Resign As Dangote Petition Shake Sector

By: Rilwan Agbomeji Nigeria petroleum sector don enter gbege as NMDPRA CEO, Farouk Ahmed, and NUPRC boss, Gbenga Komolafe, don resign Wednesday. Di resignations follow wahala wey Dangote Group President, Aliko Dangote, bring up over fuel import, pricing, and regulator wahala for downstream sector. Dangote don accuse Ahmed of economic sabotage and drag matter go ICPC, yarn say regulator spend about $5m for im pikin education for Switzerland. Di shakeup […]

todayDecember 18, 2025 8

National

Tinubu Go Carry 2026 Budget Enter N’assembly Dis Friday

By: Rilwan Agbomeji If nothing waka wrong last minute, President Bola Tinubu go carry 2026 Appropriation Bill enter National Assembly dis Friday. Before di main gbege, House of Representatives go read official letter from Presidency today (Thursday) make lawmakers and staff sabi say Tinubu go show face. Tori pipo don see di letter wey dem sign December 17, 2025, by Essien Eyo Essien on behalf of Clerk, Kamoru Ogunlana. Di […]

todayDecember 18, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app