National

1288 Results / Page 38 of 144

Background

National

Makinde Draw Line say APC No Be My Option

By: Esther Ayoola Oyo State Govo, Seyi Makinde don clear di air wetin make am buy waka enter Aso rock, say e nor get any plan to leave Pipos Democratic Parti. E tuk dis one afta e go see President Bola Tinubu for Aso Rock on Thursday. When tori pipo block am for gate, as e dey come out from Aso rock, con ask am if e wan join di […]

todayJanuary 23, 2026 7

National

EFCC Blow Whistle On Yahoo, Fake Air Ticket And Investment Scam

By: Esther Ayoola Di Economic Finance Crime Commission on Thursday don reveal new kpiance doings of yahoo and fake air ticket discount wey don rip hundreds of Nigerians dia billions of naira. According to report, One group dey run fake Airline Discount Scheme (ADS) to trap people, while another company, wey dem dey call, Fred & Farid Investment (F&F Investment), dey use fake investment plan take collobi naija pipo money. […]

todayJanuary 23, 2026 7

National

VP Shettima Open Yarning On Naija Food Security Plan

By: Esther Ayoola Nigeria don show new big plan wey go put food security for top doing, dat e go stabilize di Kontri, control inflation, and keep di region together. Na Vice Presido, Kashim Shettima tuk dis one, for high-level panel wey dem call “When Food Becomes Security” for Congress Centre during 56th Annual World Economic Forum meeting wey shelle for inside, Davos, Switzerland. Shettima say, Gornment don start wide […]

todayJanuary 23, 2026 8

National

Tinubu Swear For Hulayat Omidiran, 37 FCC Commissioners

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido Bola Tinubu on Thursday don go swear for di new chairmo and commissioners of Federal Character Commission (FCC) for State House, Abuja. Di new FCC chairperson, Hulayat Omidiran, take oath of office together with 37 commissioners wey represent di 36 states and FCT. Di ceremony hapun for Aso Rock, oga presido sha  charge di new commissioners to focus on wetin dem fit do for […]

todayJanuary 23, 2026 4

National

President Tinubu Give Go Ahead For Shell Bonga Oil Project

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu, don approve make dem gazette special incentives wey go support Bonga South West deep-offshore oil project wey Shell and im partners dey plan. Oga Presido give di approval yesterday as im receive di kontri top mehn for di Oil sector for Aso Rock. Nigeria National Petroleum Company Limited oga, GCEO, Bayo Ojulari, ni bin lead di Shell team, including their global Oga, […]

todayJanuary 23, 2026 11 1

National

Northern CAN Raise Security Concern Afta Kaduna Kidnap Denial

By: Esther Ayoola Oga  Chairmo of Christian Association of Nigeria (CAN),   northern branch, Joseph Hayab, don cut rope chain for security agencies for “denying”  jaguda boys kidnap pipo for Kaduna. Hayab yarn dis on Wednesday, hours afta Nigeria Police Force deny report say jaguda boys kidnap worshippers for Kurmin Wali community, Kajuru LGA, Kaduna. He tuk say how police and other security agencies just dey deny, dat all dis kin […]

todayJanuary 21, 2026 6

National

Court Sack Abure, Order INEC To Recognize Nenadi Usman

By: Esther Ayoola Federal High Court don go settle labour party leadership wahala, for Abuja on Wednesday,  dem rule say, Julius Abure, no longer bi  di  national chairmo of Labour Party say im tenure don expire. Na Human rights lawyer, Inibehe Effiong, na im yarn di mata for X, say im dey court when di judgment come out and say di decision follow earlier Supreme Court ruling. According to report, […]

todayJanuary 21, 2026 7

National

NDLEA Gbab 77,792 Drug Offenders, Seize 14 Ton Illegal Drugs

By: Esther Ayoola Report card don show from di Naija Drug Law enforcement Agency, say NDLEA don arrest 77,792 pipo wey dey involve for drug business and dem seize about 14,847 kilogram of illegal drugs for di past five years. Na Retired Brigadier General Buba Marwa tuk dis one to tori pipo, during dia award ceremony for NDLEA headquarters for Abuja on Tuesday. He tuk say all dis arrests and […]

todayJanuary 21, 2026 6

National

Govo Mutfwang Promise Peace, Security as Army Chief Visit Plateau

By: Esther Ayoola For Security matas, Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, don go promise say im government go continue to maintain peace, improve security and push development for im state. Mutfwang tuk dis one on Tuesday when Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, visit am for New Government House, Little Rayfield, Jos. Di Plateau govo nor waste time, praise Naija Army and other security agencies for dia strength, […]

todayJanuary 21, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds