National

1294 Results / Page 57 of 144

Background

National

FG Confirm Say New Tax Reform Laws Go Start January 1, 2026

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don confirm say dem no go reverse di new tax reform laws wey go start on January 1, 2026. Chairman of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, talk dis one on Friday afta e brief President Bola Tinubu for Lagos. E add say four tax laws don sign into law, and two of dem don already start since June 26, 2025. […]

todayDecember 26, 2025 29 61

National

Vice Presido Shettima Visit Bomb Victims For Gamboru Market Mosque

By: Rilwan Agbomeji Vice President Kashim Shettima don buy waka visit people wey wunjor for di bomb wey happen for Gamboru Market Mosque for Maiduguri, Borno State. Im go see dem wey dey hospital and carry sympathy message from Presido, Bola Tinubu and Federal Government begin share, share give dem. Shettima talk say government go still dey support di victims and dia families. According to security official report say at […]

todayDecember 26, 2025 18

National

Army Raise Alarm Over Fake DSSC 29 Recruitment Form

By: Rilwan Agbomeji Nigerian Army, through Acting Director of Army Public Relations Anele Appolonia, talk on Friday for dem official X page  don clear di air say nor be dem post  DSSC 29 recruitment advert wey dey circulate online na fake. Anele talk say Nigerian Army never announce or approve any Direct Short Service Commission or Short Service Commission recruitment for anywhere for Nigeria at dis time. Army warn Nigerians […]

todayDecember 26, 2025 17

National

President Tinubu Mourn Two Kano Lawmakers Wey Die Within One Hour

By: Rilwan Agbomeji Wi Oga Presido Bola Tinubu say, like dis dey cry seriouly over di death of two Kano State House of Assembly members. Di lawmakers, Aminu Ungogo wey represent Ungogo constituency and Aliyu Daneji wey represent Kano Municipal, die for different incidents within about one hour on Wednesday. Inside statement from im media tuk tuk, Bayo Onanuga, Tinubu call di loss sad, tragic and painful. E yarn say […]

todayDecember 26, 2025 10

National

Keyamo Shake NCAA Oga Dem Sake Of Corruption Wahala

By: Rilwan Agbomeji Minister of Aviation, Festus Keyamo, don reshuffle some big oga dem for Nigeria Civil Aviation Authority because people dey talk say corruption dey happen. Dem say di change fit get connection with poor work and weak monitoring for di Directorate of Airworthiness Standards. Meanwhile, Nigeria Safety Investigation Board release report say two different aircraft get serious incident for Kano and Owerri for December. One Hawker aircraft crash-land […]

todayDecember 26, 2025 10

National

NLC Tell Nigerians To Reject Fake Tax Laws

By: Rilwan Agbomeji Di Nigeria Labour Congress just area dey ginger Nigerians make no body gree for any tax law wey magic don enter, wey dem nor understand. Un top yanings with tori pipo for Abuja, NLC President Joe Ajaero talk say such tax policies  dey make pipo trust for gorment. E stress say tax justice mean say di rich must pay dia fair share and all unfair taxes against […]

todayDecember 26, 2025 12

National

PDP Drag FG As US First Break News Of Sokoto Terror Strikes

By: Rilwan Agbomeji Di Peoples Democratic Party don bash Federal Govment for how e allow United States release news of terror strikes for Nigeria before Nigerian authorities yarn anything. In a statement issued on Friday, di PDP National Publicity Secretary, Ini Ememobong, PDP talk say di govment delay make Nigerians dey depend on foreign sources for updates about critical security operations for dia own country. Di US first announce dia […]

todayDecember 26, 2025 10

National

Sheikh Gumi Raise Alarm Say Us Airstrike Fit Scatter Nigeria Sovereignty

By: Rilwan Agbomeji Reaction don dey trail US work for Nigeria, Islamic cleric Sheikh Ahmad Gumi don knock US airstrikes for North-West Nigeria, say e fit cause wahala and spoil Nigeria sovereignty. Dis one come afta President Donald Trump talk say US forces bomb ISIS camps to protect Christians, as Nigerian government confirm say dem dey cooperate with America on security marras. Gumi say fighting terrorists na Islamic duty, but […]

todayDecember 26, 2025 11

National

Police Burst Kidnap Plot For Benue, Save Man For Christmas Day

By: Rilwan Agbomeji Benue state police command like Jakie chan don rascal some jaguda boys wey bin plan to spoil  Christmas day, kidnap one man and say dem don rescue di man, Geoffrey Akume. Police tuk, tuk, DSP Udeme Edet, talk say di incident happen early mor mor for Tiortu area along Gboko/Makurdi road. According to police, di man dey travel from Gboko go Makurdi when armed men stop am. […]

todayDecember 26, 2025 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds