National

1294 Results / Page 56 of 144

Background

National

Presido Tinubu Cancel Part Of NNPC Debt Worth $1.42bn And N5.57tn

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido, Bola Tinubu don to cancel big part of debt wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) dey owe Federation Account. Dis na according to  Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission talk for report wey dem present at November 18, 2025, Federation Account Allocation Committee (FAAC) meeting. Di report show say the cancellation go wipe about $1.42 billion and N5.57 trillion afta both NNPC and Federation Account […]

todayDecember 29, 2025 10

National

Atiku Pray For Anthony Joshua Afta Road Accident

By: Rilwan Agbomeji Former PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, don send message of sympathy to British-Nigerian boxer Anthony Joshua afta road accident happen for Makun, Ogun State, on Monday. Atiku talk dis one through im official X handle, say e pain am well well and e dey pray make Joshua recover sharp sharp. According to am, Anthony Joshua still be symbol of strength and resilience, and e sure say e […]

todayDecember 29, 2025 14

National

Defence Minister Musa Explain Experience Say God Save Im Face

By: Esther Ayoola Defence Minister, Gen. Christopher Musa (rtd), don comout explain wetin im experience as military head, say people conspire against am and think say dem don win, but na God intervene and lift am up. E tuk dis one during church service for Conquerors Global Assembly for Abuja, where e go with im wife on Sunday. Musa explain say e decide share di testimony to thank God and […]

todayDecember 29, 2025 8

National

Resident Doctors Tell FG The Truth, Promise Fresh Strike

By: Esther Ayoola Naija resident doctors (NARD) don send SMS give wi federal gorment say dem go stop work if  FG never respect agreement wey dem sign. NARD secretary-general, Dr. Shuaibu Ibrahim, post urgent message for X on Sunday, beg senior doctors make dem hold first giving wi federal gorment 29 days from today. NARD tuk say na FG and ministry of health be di wahala, and if dem no […]

todayDecember 29, 2025 12

National

Peter Obi Ready Kaya To Join ADC

By: Esther Ayoola Presidential hopeful Peter Obi, according to report go soon officially join African Democratic Congress (ADC). According to one principal official of Labour Party for Abuja, ahead of 2027 general election, Obi go formally declare im move on December 31 for Enugu, wey be South-East political capital, after im supporters don start arrangement for di rally. According to di source, ADC ask Obi about three weeks ago make […]

todayDecember 29, 2025 10

National

FCT Minister Wike Say Im Nor Promise Tinubu PDP

By: Esther Ayoola Di honourable minister of di Federal Capital Territory don bring out im weapons of mouth destruction sama governor Seyi Makinde of Oyo state wetin nor good, say im lie for national TV Wike drop all di lines wey im fit drop for TV sitdon tuk with tori pipo on Monday, say, im nor promise president Tinubu say im go hold di Pipos Democratic Party down for am […]

todayDecember 29, 2025 8

National

Obi Explain Why Im Wan Contest 2027 Elections

By: Esther Ayoola Di labour party 2023 presidential candidate and former Anambra state governor, Peter Obi,  don clear men doubt  say e go run for 2027 presidential election. E make di announcement on Sunday night, during live X space session wey @obidientupdate host, e explain everything about him political future. Mens and better yanriyans gather for di X space, enter meeting with obi. Obi use di chance tuk about Nigeria […]

todayDecember 29, 2025 10

National

Wike Fire Bullet Say APC No Mean Automatic Second Term Ticket

By: Esther Ayoola FCT Minister Nyesom Wike don tire shirt, enter area for River state, say joining APC or openly pledging loyalty to President Bola Tinubu no mean automatic ticket for second term. Wike tuk dis one when e dey address supporters for Emohua Local Government Area of Rivers State during im political consultation. Di minister use di meeting remind party members say loyalty and agreement for politics suppose get […]

todayDecember 29, 2025 7

National

President Tinubu Leave Lagos Go Europe, Set For Abu Dhabi Summit

By: Esther Ayoola Afta joliment for Lagos, say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don leave Lagos go Europe on Sunday, December 28, for im  end-of-year break and dat afta dat, im go enter area for United Arab Emirates for official trip. According to statement from President tuk tuk, Bayo Onanuga, say Tinubu go enter Europe flex small den, go later travel from Europe go Abu Dhabi to attend di […]

todayDecember 29, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds