National

1294 Results / Page 76 of 144

Background

National

Naira Sharp Rise Against Dollar After CBN Retain Interest Rate

Naira don sharply rise against US dollar for official forex market after Central Bank of Nigeria (CBN) retain 27 per cent interest rate. CBN data show say naira strengthen reach N1,446.32 per dollar on Tuesday, up from N1,453.85 wey dem trade on Monday. Dis one mean say naira gain N7.52 in one day, di highest in di last two weeks. For black market, naira still dey stable at N1,465 per […]

todayNovember 26, 2025 7

National

Fubara Approve Make Dem Upgrade NYSC Facilities For Rivers

Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don approve make dem upgrade and renovate NYSC Orientation Camp facilities for Rivers State. Di governor give di approval on Tuesday when e dey receive NYSC Director-General, Brigadier General Olakunle Nafiu, for Government House, Port Harcourt. Fubara talk say Rivers State still dey peaceful and hospitable, and e no shock am say plenty graduates and parents dey prefer di state for national service. E add […]

todayNovember 26, 2025 7

National

Why We Still No Dey Open Our Business For Mondays — South-East People

Despite better security for South-East after years of insecurity, some commercial cities still no dey open business on Mondays; shops remain locked, and even wey dem open, activity dey very scanty. Banks sef no dey operate for Monday. Places like Aba, Okigwe, Onitsha, Nnewi and other growing urban centres still dey slow on Mondays, with some reluctantly opening from 12 noon. But for capital cities, full commercial and social activities […]

todayNovember 26, 2025 7

National

NDLEA Don Seize ₦6.7bn Worth of Tramadol, Codeine From Lagos Warehouse

Operatives of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don clamp down on one big opioid cartel as dem recover illicit drugs wey worth over ₦6.7bn from dia secret warehouse inside one residential estate for Lagos State. According to statement wey Director of Media & Advocacy, NDLEA, Femi Babafemi, drop for Abuja on Wednesday, di bust happen as dem arrest suspected drug baron, Onyekachi Pius Nwanagu, plus five members of […]

todayNovember 26, 2025 6

International

EU Go Support Ukraine ‘Every Step Of Di Way’ Until Peace Show

Di President of di European Commission, Ursula von der Leyen, don vow say Europe go stand gidigba with Ukraine and support dem every step of di way until dem achieve “just and lasting peace”. She tell EU lawmakers on Wednesday say di revised US plan to end di war fit be “starting point”, even as Europe dey scramble to boost Ukraine and counter US proposal wey many see as tilted […]

todayNovember 26, 2025 6

National

Bandits: Govt No Rescue Schoolgirls, Na Negotiation Dem Do

A new video don surface show say Nigerian government and di bandits wey kidnap di Kebbi schoolgirls negotiate and reach agreement before dem release di girls. Dis video contradict government claim say no ransom enter as dem free di students of Government Girls Secondary School, Maga, Kebbi State, on Tuesday. For di clip wey @AM_Saleeem share for X, one armed bandit dey question di girls about military jets wey fly […]

todayNovember 26, 2025 7

National

How To Collect Your Pension Before You Retire

Under di National Pension Commission (PenCom) rules for Contributory Pension Scheme, Nigerian workers fit access part of dia retirement savings while dem still dey work, but e get conditions. Both employer and employee dey contribute monthly to Retirement Savings Account (RSA), and normally di savings dey for pension income at retirement. But if worker lose him job and no get another one for at least four months, e fit withdraw […]

todayNovember 26, 2025 11

National

Abducted Kebbi Schoolgirls Release No Be Victory – Atiku

Former Vice President Atiku Abubakar don criticise di Federal Government over di release of abducted schoolgirls for Kebbi State, yan say di girls freedom no suppose be achievement but show how Nigeria security don worsen. Atiku talk say di return of di schoolgirls no be “trophy moment” but na reminder say terrorists dey operate freely, dey negotiate openly, and dey dictate terms while government dey issue press statements to save […]

todayNovember 26, 2025 6

National

Papa Of Three Kidnapped Niger Children Don Die — CAN

Di Chairman of Christian Association of Nigeria (CAN) for Northern Region and FCT, Rev. John Hayab, yan say one papa don die of heart attack after dem kidnap him three children for St Mary’s Catholic School, Niger State. Hayab talk say di trauma wey families dey face for Kebbi, Kwara, and Niger over di past week dey very serious. Di man, wey dem call Mr Anthony, shock gangan over di […]

todayNovember 26, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds