Voters inside Israel dey vote to elect 120 members of dia parliament, wey dem dey call Knesset, dis na di first general election since de war start for Gaza for October 2023.
We hear say Prime Minister, Benjamin Netanyahu party, Likud, plus dis hin far-right alliance dey sweat dia life say dem dey face strong opposition group wey di former army chief, Gadi Eisenkot party, Yashar, join lead.
Dis election dey hapun to correct all di yamayama bad corruption doings, and security wahala for inside Israel.
Oda issues wey also dey make head shake for di campaign na di fight over whether to disqualify Arab-led parties from di election.