Lagos

Building Collapse for Ijegun Kpai One Worker

todayOctober 27, 2026 7

Background
share close

One pesin don kpai inside building collapse for Lagos, oda victim don kpeme, as dis-one collapse for Adedoyin Street, Ijegun, Ikotun area of Alimosho.

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) naim dey konfamate dis update inside statement  wey dem wrap like moimoi on Monday.

Say dem receive di call around 1:44 pm before dem send dia  Igando Beta Team go de scene.

When di rescue team reach di place, dem discover say workers dey manually pull di building down before di structure come collapse on dem.

LASEMA tok tok, Olufemi Damilola, explain say one worker dey trap under di heavy building scata scata until hin kpai, while another worker sustain wunjury for hand.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds