National

1095 Results / Page 8 of 122

Background

National

Amotekun Officer Testify Say E Knack Bullet With Owo Church Attackers

By: Esther Ayoola One Amotekun officer wey dem dey call SSG don testify for Federal High Court for Abuja say e fight gun battle with one of di pipo wey attack St. Francis Catholic Church for Owo on June 5, 2022. E say afta dem hear wetin hapun, dem rush enter bush based on information from eyewitnesses and meet di attackers as dem dey run. SSG tuk say when e […]

todayFebruary 11, 2026 4

National

President Tinubu Drop Yarns On How To Make Naija Economy Strong

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu, once again don loud doings say im wan give Naija economy ordechi, make  di economy strong, kakarakokoro. Im yan dis one for di second day of di  National Economic Council (NEC)  conference. Na Senate Presido, Na Godswill Akpabio, represent am, take tuk di tuk, promising say e go push reforms wey go bring betalicious result to di obodo Nigeria.

todayFebruary 11, 2026 2

National

Atiku Sukili Mouth For Electoral Act Mix-Up

By: Esther Ayoola Former Vice President Atiku Abubakar sef don join dey drag di naija Senate over di way dem handle di Electoral Act mata, say mixing manual and electronic transmission (e go be like rice and ogbonor mixed together,)  dat e go make election result drag. Di senior man yarn dis one afta im visit former military Presido Ibrahim Babangida for Minna with Oyo State Govo, Seyi Makinde. Atiku […]

todayFebruary 11, 2026 4

National

Suspected Herdsmen Kpai, Kpai Five, Kidnap 14 For Benue Villages

By: Esther Ayoola Say Five pipo don Kpai for Entekpa community, Adoka, Otukpo LGA, Benue State afta suspected armed herdsmen attack. According to report, di Gunmen still ambush one commercial bus for Utonkon, kpai two passengers, and kidnap 14 people. Some villagers for Adoka suffer gunshot wounds, while plenty others don miss. Eyewitness say, di attackers come with plenty cows, then suddenly start to shoot pipo and burn house. Ward […]

todayFebruary 11, 2026 4

National

Dangote Lower PMS Price To New Rate Of N774

By: Esther Ayoola Dangote Refinery say dem don reduce di gantry price of Premium Motor Spirit (PMS) by N25 per litre. Di Group Commercial Operations Department yarn marketers on Monday say di new ex-depot rate don drop from N799 go N774 per litre. Dem say di reduction dey effective immediately. Di Dangote group also add dat, di PMS lifting incentive don finish, and di move go make locally refined fuel […]

todayFebruary 11, 2026 3

National

US Humanitarian Group Land Southern Kaduna To Check Public Hospitals

By: Esther Ayoola Senator wey dey represent Kaduna South, Sunday Katung, don carry one humanitarian group from America, Project C.U.R.E., to checkmate some public hospital for Southern Kaduna. Katung say di team, wey Rose Polycarp, wey be registered nurse from US dey lead, come assess how health facilities and services dey work for Kaduna. Say Dem don already visit Kagarko General Hospital, Kachia General Hospital and General Hospital Gwantu, while […]

todayFebruary 10, 2026 3

National

FG Hail Committee As Naija Collobi IMO Council Seat

By: Esther Ayoola Di  Federal Government don commend nine members of Inter-Ministerial Committee wey help Nigeria secure Category C seat for International Maritime Organisation (IMO) Council, di Minister of Marine and Blue Economy, Dr Adegboyega Oyetola, yan on Tuesday for Lagos. Oyetola tuk say di commendation follow di committee contribution wey naija Nigeria to win di seat for 2026–2027 biennium. Nigeria secure di seat during IMO Council elections wey hold […]

todayFebruary 10, 2026 4

National

Osogbo Imam, Four Others Enter Court For Murder Case

By: Esther Ayoola Imam Abdulgafar Sakariyah, and four oda people don appear for Osogbo Chief Magistrates’ Court over how one worshipper, Ahmed Najeem, kpai during early morning prayers. Say dem jaguda boys beat Najeem afta e allegedly try to attack Imam for Ummu Haani Adigun Memorial Central Mosque on January 30. All of dem do face like stonecold as police arrest dem for di murder charge. Say aproko pipo now […]

todayFebruary 10, 2026 6

National

Oyo Princes Drag Alaafin Owoade Go Court

By: Esther Ayoola Say Alaafin of Oyo, Oba Akeem Owoade, don dey chest court wahala wey some Oyo princes file against am. Di princes, Ladigbolu Adegboyega, Owoade Tesleem, Adeyemi Adesina, and Adeyemi Adebayo, dey ask court make stop Oba from some function wey im nor suppose attend. Dem sti tell court make e no dey act like say e dey below any other Oba for Yorubaland. Dem say, Alaafin office […]

todayFebruary 10, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app