insert_link National Vice Presido Shettima Carry Swear Go Swear For New Côte D’ivoire Presido By: Esther Ayoola Wi Vice Presido, Kashim Shettima don enter Abidjan, Côte d’Ivoire, to stand in for im oga President Bola Ahmed Tinubu for President Alassane Ouattara fourth-term inauguration wey on shelle today. The update come from Senior Special Assistant to the President on Media and Communications, Stanley Nkwocha. Shettima go join plenty African leaders and international big names take swear for the new presido inside the ceremony wey go […] todayDecember 8, 2025 6
insert_link National Oluremi Tinubu Yan Marras Dat Nigeria Go Soon Dey Borrow Other Countries Money By: Alice Iduh First Lady, Senator Oluremi Tinubu, dey show doings, yanyanpu say, one day Nigeria go dey borrow money to other countries, and that better prosperity dey front. She yarn this one on Sunday for Ile-Ife, Osun State, after dem give her chieftaincy title, Yeye Asiwaju Gbogbo Ile Oodua. The event still mark the 10th coronation anniversary of Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, wey attract big […] todayDecember 8, 2025 7
insert_link National PDP Factional Bot Support NWC To Stabilise Party By: Esther Ayoola Di pipos democratic party factional Board of Trustees (BOT) wey dey follow FCT Minister, Nyesom Wike, don talk say dem go work hand-in-hand wit di PDP National Working Committee (NWC) to make sure di party balance well. Di Chairman of di factional BOT, Senator Mao Ohuabunwa, yarn dis one on Sunday for di opening of dia meeting wey dem hold for di Minister Life Camp residence for […] todayDecember 8, 2025 2
insert_link National Tinubu Collect Diplomatic Letters From 21 Envoys President Tinubu don collect diplomatic letters from 21 new envoys, 17 ambassadors and four high commissioners, inside Council Chamber. Tinubu talk say Naija ready to strengthen friendship, push cooperation and stand strong for peace and progress across borders. Japan ambassador, Suzuki Hideo, call di ceremony historic and hail Nigeria as ECOWAS heavyweight. Envoys come from Japan, Chad, Gabon, Türkiye, Palestine, Spain, Indonesia, Mauritania, Austria, Thailand, Bangladesh, Sweden, Czech Republic, Liberia, […] todayDecember 5, 2025 24
insert_link National Reps Drag Women Affairs Ministry On Gender Equality And Welfare Di House of Reps committee on women affairs don yarn make Ministry of Women Affairs deliver proper, dey promote gender equality, protect women and girls rights, and push welfare mata well well. Di committee chairperson, Hon. Kafilat Ogbaran yarn dis dis week during oversight meeting with Hajiya Imaan Ibrahim for National Assembly. She yarn say dis oversight na to confirm say money wey dem dey drop go giv Naija women […] todayDecember 5, 2025 11
insert_link National Imo Police Burst 2 Kidnappers, Nab 12 By: Rilwan Agbomeji Imo police don scatter 2 kidnappers, lock 12 for ceil, recover one dead body, dangerous weapons and 12 phones for Obudi/Mgbala Road and Umuezeruokam Forest. DSP Okoye yarn say DPO squad run down geng wey dey use white mini bus, while CP Danjuma promise say dem no go gree for kidnappers again. Meanwhile, police don para, reject all talk say dem dey do human rights wahala for […] todayDecember 5, 2025 10
insert_link National Tinubu 65 Ambassadorial Nominees Brace For Senate Grilling By: Rilwan Agbomeji Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not. Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem. For Thursday main […] todayDecember 5, 2025 16
insert_link National Obi Blast Campaign – Cars Dey Scatter, Priorities Dey Lost By: Rilwan Agbomeji Labour Party 2023 Presidential Candidate, Peter Obi don drop mata for ground say di way all dis big politicians take dey spend money on top big big motor, na concern. Obi talk say for time wey Naija pipo neva chop, no gey job , dey fear kidnaping, ni senior political big names dey spend public money buy big big motor for political campaign, say e no good […] todayDecember 5, 2025 7
insert_link National Suspects Don Yarn Reason Why They Kpai Ogun FRSC Officer And Her Pikin By: Rilwan Agbomeji Osun State police command don kramp one jaguda boi, victor fajemirokun wey kpai im girl friend, wey be Federal Road Safety Corps officer, Lasisi Funmilayo and her pikin, Sewa Lasisi. According to reports, di police parade di forty years old business man alongside two babalawo wey dia name be, Gboyega Daramola and Sunday James, for Osun State Police HQ, Osogbo on Wednesday. Oga Victor open im mouth […] todayDecember 4, 2025 5