OBODO NAIJA

770 Results / Page 76 of 86

Background

OBODO NAIJA

NDLEA Bust Big Drug Syndicate, see  Cocaine wey dem Hide

Wi National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don buy robo cup waka scatter one big drug syndicate for Lagos, say dem don dey track am for three weeks. Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi,  na im dey yarn dis one on Sunday for Abuja. say dem discover cocaine wey dem hide for tins wey get palm kernel extract. Dat di plan before na to send di drugs go United […]

todayApril 6, 2026 20

OBODO NAIJA

How Oga Presido Tinubu Dey Get Sleepless Night Because of Insecurity

Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris,  say like dis, wi oga  Presido Bola Tinubu dey work harder now to join hand with other countries make dem fit stop insecurity for Nigeria. Idris yarn dis one to journalists after im meet di President for Lagos on Sunday. Im talk say Tinubu dey reach out to neighbouring countries and international partners to fight problems like terrorism wey don scatta […]

todayApril 6, 2026 31

OBODO NAIJA

Wike Confirm Say PDP Go Enter 2027 Election

Federal capital territory minister, Nyesom Wike don share update say Pipos Democratic Party go surely contest for 2027 general election, despite wetin pipo dey tuk say di party no get wait again. Im yarn dis one on Friday during one media meeting, wia im clear every, say PDP still dey strong even though say dem never produce president since 2015. According to Wike, di party need focus more on state […]

todayApril 3, 2026 37

OBODO NAIJA

EFCC Seek Court Order To Take 57 Malami Properties

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don tell Federal High Court for Abuja say dem wan court to take over di 57  properties wey get connection with former Attorney General, Abubakar Malami. EFCC, through dia lawyers Jibrin Okutepa (SAN) and Ekele Iheanacho (SAN), tuk say, pipo wey dey defend Malami never show good reason to cancel di earlier interim forfeiture order. Di mata involve Malami, Hajia Bashir Asabe, Abiru’ […]

todayApril 3, 2026 22

OBODO NAIJA

INEC Reject ADC Call Make Chairman Amupitan Resign

In response, INEC say dem nor go accept any jaguda doings to force Chairmo, Prof. Joash Amupitan, to resign. INEC Chief Press Secretary, Adedayo Oketola,  put for statement on Thursday, say demand for Amupitan resignation na attack on di Commission wey dey independent. Di statement follow ADC call wey dey accuse INEC of favouring some political party and asking Amupitan to comot office. INEC explain say di claim of bias […]

todayApril 3, 2026 30

OBODO NAIJA

ADC Put Call For INEC Chairmo Sack

African Democratic Congress (ADC) chairmo, David Mark, don call make dem sack INEC chairmo, Prof Joash Amupitan say, im nor know im work. E run dis one for one join body press conference wey dem run for Abuja yesterday, say INEC dey bias. According to David Mark, moral dey very, very, low, say Nigerians nor get confidence for Amupitan and all di national election, commissioners.

todayApril 3, 2026 32

OBODO NAIJA

First lady, Remi Tinubu Launch Food Bank Programme To Fight Hunger

Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don launch National Community Food Bank Programme to fight hunger and malnutrition, and dat e go reach 500,000 households for first year. She explain  for di meeting wey sup for Abuja say di programme, don already get over N65 billion support from gornment, and senior mehns from di country According to senator Oluremi, dem go run am through beta collabo with donors, development partners […]

todayApril 3, 2026 24

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Talk Tough For Jos Attack, Say Peace Must Reign

Wi oga Presido Bola Tinubu on Thursday don finally visit di palm Sunday attack victims for Jos, Plateau State. E say dis one na to calm tension and make justice hapun. For there, senior man Tinubu tell di Nigeria police and soldiers to go after di killers con sti order di plateau gorment to  install CCTV cameras for betament security doings for di state.

todayApril 3, 2026 23

OBODO NAIJA

Ogun Gorment Close Ijebu Ode School After Gas Leak

Ogun State gornment don order say Our Lady of Apostles Secondary School for Ijebu Ode make dem close am after suspected gas leak wey hospitalize about 30 students and staff. Di gbege hapun on Wednesday just after school assembly, when some kind gas spread across di school compound. Commissioner for Environment, Ola Oresanya, tuk on Thursday say Governor Dapo Abiodun don direct security agencies make dem investigate how di incident […]

todayApril 3, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds