OBODO NAIJA

770 Results / Page 78 of 86

Background

OBODO NAIJA

Kwankwaso Dump NNPP, Join ADC for Kano State

Di 2023 NNPP presidential candidate and ex-Kano governor, Senator Rabiu Kwankwaso, don officially join African Democratic Congress (ADC) on Monday, March 30, 2026, for Gidan Kwankwasiyya, Miller Road, Bompai, Kano. Kwankwaso register with di party and collect im membership card in front of top politicians like ADC chairman David Mark, Aminu Tambuwal, Rotimi Amaechi, Peter Obi, Dino Melaye and John Odigie-Oyegun. Although Kwankwaso no fully explain why, but say im […]

todayMarch 30, 2026 35

OBODO NAIJA

Tuggar Dump Foreign Affairs Job, Set Eye for Bauchi Governor Seat

Oga Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Tuggar don resign from im position to follow im political plan to run for Bauchi State governor. Di ministry tuk tuk, Kimiebi Ebienfa, na im dey konfamate di resignation on Monday. Before now, report bin don show say Tuggar dey among four ministers for President Bola Tinubu cabinet wey go resign to pursue political ambition. Even di minister media aide, Alkasim Abdulkadir, don […]

todayMarch 30, 2026 23

OBODO NAIJA

ADC Chairmo Pikin, Blessing Onuh, Join Tinubu Re-election Campaign

ADC National Chairmo Senator David Mark, pikin, Hon. Blessing Onuh, don join front line to support President Bola Tinubu re-election. she put for statement on Saturday say D.G. of Take Action Campaign Organisation wey dey push Tinubu second term, Tony Nwulu, don present her appointment letter and dat she go be National Woman Leader. Onuh pledge say she go work hard to make sure Tinubu win, even as her papa […]

todayMarch 29, 2026 27

OBODO NAIJA

Spain Release Arsenal Midfielder Zubimendi Over Knee Wahala

Spain don release Arsenal midfielder Martin Zubimendi from dia squad. According to Spain Football Federation  on Sunday,  say na to protect im health and avoid any serious pain to di knee. Zubimendi play small as substitute for Spain 3-0 win over Serbia on Friday. Im nor go play friendly against Egypt for Barcelona on Tuesday.

todayMarch 29, 2026 27

OBODO NAIJA

ADC Reason Ways To Use Consensus To Pick Dia 2027 President Candidate

Di African Democratic Congress (ADC) say like dis dey reason to use consensus take pick dia presidential candidate for 2027 election. Party tuk tuk, Bolaji Abdullahi, yarn dis one for TV sit down tuk, on Saturday. E say dem fit still use direct primaries, but dem don comot indirect primaries from law. Dem prefer consensus wahala pass, as e go cost dem less money.

todayMarch 29, 2026 26

OBODO NAIJA

Kwankwaso Resign From NNPP To Joinbodi With Oda Parti

Former Kano State govo Rabiu Musa Kwankwaso like dis now don catapult imself comot di New Nigeria People’s Party with immediate effect. E tok dis one for statement on Sunday say di decision no easy at all, but based on di move to save naija need new alignment na im make am comot di parti. Kwankwaso explain say e need join another platform wey go give am beta chance to […]

todayMarch 29, 2026 19

OBODO NAIJA

Troops Gbab 98 Illegal Miners For FCT

Troops of 176 Guards Battalion arrest 98 people wey dey do illegal mining for Gwagwalada Area Council, FCT on March 23. Zagazola Makama post for X say di raid happen around 5:55 p.m. after intelligence show illegal mining dey go on for di area. Troops storm di site, catch di suspects without wahala, and recover vehicle, motorcycles, pumping machines, shovels, sledgehammers, and other mining tools. Di arrested miners don hand […]

todayMarch 26, 2026 38

OBODO NAIJA

How Women Form Vigilante Team For Plateau State

Some group of women based on gbege for area for Jos don form vigilante group as jaguda boys no allow dem drink water keep cup dey patrol streets for night. Di group oga, Blessing Ngozi Emmanuel, ni yan pipo dis update on Wednesday, on how e take dey do dem for di Jos. She press tuks on how both Christian and Muslim women take dey do collabo, sacrifice dia comfort […]

todayMarch 26, 2026 34

OBODO NAIJA

Navy, Police Join Hand, Vow To Rascal Insecurity

Nigeria Navy and Police don agree say dem go work closer together to fight security wahala wey dey grow for country. Na for one join bodi meeting  for Abuja, Police oga Olatunji Disu meet Navy boss Idi Abbas, yarn dis one Di Navy promise say dem go continue to support joint operations and even train Marine Police for dia facilities. Oga IGP thank di Navy for dia support, especially for […]

todayMarch 26, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds