obodo oyinbo

429 Results / Page 18 of 48

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Land Kenya Ahead Africa-France Summit for Nairobi

By: Jolayemi Olajide Wi oga Presido,  Bola Tinubu, AKA baba seyi don arrive Nairobi, Kenya, ahead of the Africa-France Summit wey go start later on Monday. State House media office tok say di Airbus A330-200 wey carry Tinubu land for Jomo Kenyatta International Airport around 12:15 a.m. local time after him leave France for di second leg of im three-country tour. During him visit to France, Tinubu meet global investors […]

todayMay 11, 2026 14 3

obodo oyinbo

Lebanon Konfam Say Israeli Strike Kpai 51 People Even With Ceasefire

By: Esther Ayoola Lebanon Health Ministry dey cry wetin nor good oh say, Israeli attacks for southern Lebanon don sti go kpai 51 pipo, including two medical workers, as dem carry out strikes for Qalawiya and Tibnin for Bint Jbeil district. Dem accuse Israeli forces say dem violate international law by targeting health centres and emergency workers, even with US-brokered ceasefire. According to di ministry, since March 2 when new […]

todayMay 11, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Reject Iran Peace Terms, Say Gbege Fit Burst Again For Middle East

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump, don comot body for Iran peace deal, say dia terms nor make sense at all. Like dis, trump rejection, don dey increase fear say, gbege fit start again for Tehran. Earlier on Sunday, Iran reply US last peace proposal, but warn say dem fit retaliate if US carry out any new attack. Iran also tuk say dem no go allow more foreign warship […]

todayMay 11, 2026 11

obodo oyinbo

US Wan Rush Comot Americans From Hantavirus Ship

United States don talk say dem dey arrange evacuation flight to carry Americans wey dey inside one cruise ship wey hantavirus don affect, as di ship dey head go Canary Islands. According to one spokesperson from di U.S. State Department, government dey work to make sure say all American passengers return home safely. Dem also talk say dem dey cooperate with government of Spain and other U.S. agencies to handle […]

todayMay 9, 2026 18 2

obodo oyinbo

Mexico Wan Close School Sake of World Cup and Hot Weather

Mexico government don yarn say dem go close schools 40 days before normal time because World Cup dey come and hot weather don too much for many parts of di country. Education oga Mario Delgado na im yarn dis one on Friday for one event wey happen for Sonora, Northern Mexico, say dem go close school on June 5 make pikin and teachers no suffer for di serious heat, and […]

todayMay 9, 2026 15

obodo oyinbo

Ethiopia Woman Born 5 Pikin After 12 Years of Waiting

By : Jolayemi Olajide One 35-year-old woman, Bedriya Adem, don born rare quintuplets for Harari Regional State for Ethiopia after she wait 12 years to get pikin. According to report, She deliver four boys and one girl through Caesarean section on Tuesday evening. Doctors for the hospital talk say both di mama and the babies dey healthy, and di newborns weigh between 1.3kg and 1.4kg. Medical director of the hospital, […]

todayMay 8, 2026 23

obodo oyinbo

Germany Finance Minister Blame Trump Iran War As Tax Revenue Go Down For Germany

By : Jolayemi Olajide Germany finance minister Lars Klingbeil like dey vex wetin nor good dat, Donald Trump “ war for Iran”  dey scata tins for dem, say na wetin cause big drop for germany expected tax money. Di German Finance minister yarn dis one for news tuk on Thursday, dat, di US presido action don really bring global energy down and e dey affect economy worldwide. Say Germany don […]

todayMay 8, 2026 16

obodo oyinbo

US Top Diplomat Rubio Enter Vatican Meet Pope Leo XIV To Tuk About Iran War

By : Jolayemi Olajide US Secretary of State Marco Rubio don finally enter Vatican on Thursday go meet Pope Leo XIV, wey be di first US pope. Dis meeting sef dey follow tension between White House and Vatican over Pope position on di war for Iran. Rubio, wey be Catholic, on clear mata “say na serious tuk” e wan do with di Pope and Vatican top diplomat Pietro Parolin. Vatican […]

todayMay 8, 2026 15

obodo oyinbo

More Hantavirus Cases Fit Show – WHO

World Health Organization don talk on Thursday say more hantavirus cases fit still show up, but if people follow safety rules, di outbreak go likely stay limited. Di warning come after di virus kpai three passengers from cruise ship MV Hondius, as another sick passenger land for Europe earlier that day for treatment. Di ship dey head go one Spanish island as health officials dey rush trace di outbreak of […]

todayMay 7, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds