obodo oyinbo

580 Results / Page 20 of 65

Background

obodo oyinbo

Heatwave Kpai 2,700 People for England, Wales

By : Jolayemi Olajide Person wey dey naija, and other part nor knw wetin God do for am, say like dis, at least 2,700 pipo kpai for England and Wales because of serious heatwaves wey hapun for May and June. According to research wey dem package for Imperial College London, heat wave don make pipo get igbeke, na so dia body dey red, u knw oyinbo na, e be like […]

todayJuly 13, 2026 11

obodo oyinbo

Federal Gorment Match break say no to WAEC AND NECO Increase Reg Fees

By : Jolayemi Olajide Finally, small air don enter di room as di Federal Ministry of Education announce on Monday say dem go wait, dat dem nor dey increase WAEC and NECO registration fee to 50k. Everywia first blur when mehnmehn wak up on Monday hear say dem don increase WAEC and NECO fee, na so dragging start across di obodo Nigeria. Officials inside Abuja code dis suspension because dem […]

todayJuly 13, 2026 16

obodo oyinbo

Iran Guards Close Down Hormuz Strait Till Further Notice

By: Yusuf Abuh Iran Revolutionary Guards don announce say Strait of Hormuz go remain closed until further notice after dem fire warning shots inside one vessel wey dodge enter di area. Di Guards say di ship ignore several instructions to use approved shipping corridor before dem stop am. According to aproko pipo, dis development fit make US-Iran kpokpo demselves again as both sides dey face tension after recent attacks and […]

todayJuly 13, 2026 23

foreign

Russia Rain Missiles, Drones on Ukraine, kpai  Four Pipo

Edited by Ebi Oboko Russia launch don go  fresh drone and missile attacks on Ukraine overnight, kpaing at least four people. According to Ukrainian officials, Di attacks happen just one day before Ukraine allies go meet for Paris to discuss fresh ways to pressure Russia make di war end. Ukraine air defence system don dey struggle as Russia continue to fire ballistic missiles in recent weeks.

todayJuly 12, 2026 29 19

obodo oyinbo

 Iran Drop Revenge List, Name US, Israel Leaders

Edited by Ebi Oboko One Iran newspaper wey dem dey call,  Hamshahri, don release  list of 13 foreign leaders wey Iran dey plan  revenge for di kpaing of former Supreme Leader Ali Khamenei. Di list include leaders from United States, Israel and some European countries, an dis one comout late  Saturday. Khamenei son and successor, Mojtaba Khamenei, vow say revenge must happen, saying those wey dey on di list no […]

todayJuly 12, 2026 23 12

obodo oyinbo

NATO, EU Leaders Mourn US Senator Lindsey Graham

Edited by Ebi Oboko NATO boss, Mark Rutte and European Union chief Ursula von der Leyen don mourn US Senator Lindsey Graham wey kpai, kpai recently,  age of 71. Graham, wey be close ally of US President Donald Trump, reportedly kpai on Saturday after brief and sudden illness. Rutte describe Graham as strong supporter of America and NATO, wey also work hard to help end Russia war against Ukraine. Von […]

todayJuly 12, 2026 14 12

obodo oyinbo

Trump Raise Alarm, Warn Iran Not to Try Nonsense

Edited by Ebi Oboko US Presido,  Donald Trump don warn say America go completely destroy Iran if dem try say naim him Iran dey target for  office to Kpai. Trump write for him Truth Social page say plenty missiles don ready and di US military don receive order to respond if any attack hapun. According to am, di military fit launch massive operation against Iran and continue am for one […]

todayJuly 11, 2026 24 3

obodo oyinbo

America, Iran To Restart Peace Tuk Despite Ceasefire End

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido,  Donald Trump don drop micro soft word  say America go continue peace tuks with Iran, even as after dem announce say cease fir don end. Trump tok dis one for im Truth Social page, wia e make am clear say di truce no dey again. E also blast Iranian leaders, call dem "bad pipo," and say na dem go decide whether dem go return […]

todayJuly 10, 2026 19

obodo oyinbo

Zelenskyy Want Ukraine Start To Dey Produce Patriot Missiles

By : Jolayemi Olajide Ukraine President Volodymyr Zelenskyy don say im country must quick start to dey produce Patriot interceptor missiles after America agree to give dem licence for di production. Zelenskyy tok dis one after im return from NATO summit, saying President Donald Trump don already approve di plan and now na for technical teams to begin work sharp-sharp. According to am, local production go help Ukraine tackle shortage […]

todayJuly 10, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds