obodo oyinbo

429 Results / Page 16 of 48

Background

obodo oyinbo

How Israeli Attack For Gaza Kpai 8 Pipo, Kpai Community Kitchen Workers

By: Esther Ayoola Say nor be small tin sup For Gaza on Sunday, dat Israeli attack kpai at least eight Palestinians, including three pipo wey dey work for community kitchen for Deir el-Balah. Reports tuk say di attack for Deir el-Balah, target di community kitchen workers. Hamas react say, di attack na war crime and dem accuse Israel say dem dey target civilians and groups. According to Gaza Health Ministry, […]

todayMay 18, 2026 10

Health

Ebola Outbreak Hit Eastern DRC As Health Authorities Raise Alarm

By : Jolayemi Olajide Di Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC) don konfam fresh outbreak of Ebola virus for eastern part of Democratic Republic of the Congo, on Friday. Say like dis, di disease don kpai some persons. Reports show say about 246 suspected cases and 65 deaths don already record, while 4 deaths don also happen among laboratory-confirmed cases. Africa CDC say di outbreak dey centered […]

todayMay 15, 2026 23

obodo oyinbo

Wahala for UK Labour Party as Health Secretary Resign put  more  Pressure on PM Starmer  

By : Jolayemi Olajide Fresh political pressure don land for UK Prime Minister Keir Starmer after di Health Secretary resign from office. Di resignation happen amid growing tension inside di Labour Party, as party members dey question leadership decisions and government handling of key issues. Reports say di move don increase pressure on Starmer to quickly stabilize im cabinet and rebuild confidence within di party. Political observers for UK say […]

todayMay 15, 2026 12

obodo oyinbo

Iran Football Federation Talk Say Dem Never Collobi US Visa Till Now

By : Jolayemi Olajide Iran Football Federation Oga, Mehdi Taj, don talk say till now, dem never issue visa give Iran national team to enter United States for 2026 World Cup. According to state media, Taj talk say dem go get crucial meeting with FIFA in di next one or two days, say FIFA must give dem clear guarantee because di visa matter never still clear. According to Mehdi Taj, […]

todayMay 14, 2026 15

obodo oyinbo

Hezbollah Fire beta bomb for Israeli Positions for Southern Lebanon

By : Jolayemi Olajide Hezbollah don announce say based on di warling film for Lebanon dem fire wetin nor good for two Israeli military positions for southern Lebanon, saying na response to alleged ceasefire violations. For separate statements, di group say dem target di newly established Balat military site and another gathering of Israeli soldiers for Rashaf on Thursday afternoon. According to Hezbollah, di first attack happen around 2:25pm local […]

todayMay 14, 2026 12

obodo oyinbo

Xi Jinping Warn Trump Say Taiwan Matter Fit Cause Serious Wahala

By : Jolayemi Olajide Chinese Presido, Xi Jinping don warn US Presdio, Donald Trump say Taiwan matter fit scatter dia relationship go war level if dem no handle am well. Xi talk dis one for high-level meeting wey happen for Beijing on Thursday, where both leaders meet for more than two hours for Great Hall of di  People. According to Chinese foreign ministry, Xi tell Trump say Taiwan na di […]

todayMay 14, 2026 11

OBODO NAIJA

Nigerian-Born Professor Rent Flat for Jail  for  US Over $1.4m Fraud Case

By : Jolayemi Olajide A United States federal court don sentence Nigerian-born former nonprofit CEO, Dr Nkechy Ezeh, to 70 months imprisonment for $1.4 million fraud wey involve mismanagement of taxpayer and donor funds meant for vulnerable preschool children. Di sentence come from Chief US District Judge Hala Y. Jarbou for Western District of Michigan, who also add separate 60-month term for tax evasion and order restitution payments. According to […]

todayMay 14, 2026 11

obodo oyinbo

UAE Clear Air Say No Secret Visit From Netanyahu

By : Jolayemi Olajide United Arab Emirates don deny report say Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu do “secret visit” enter di country during war wey involve US and Israel against Iran. For statement wey dem wrap like moimoi naim di UAE state news agency WAM dey clear dis mata say dia relationship wit Israel dey open. UAE gornment still maintain say all their engagement wit Israel dey public and transparent.

todayMay 14, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Send Dia World Cup Team Off With Loud Ceremony For Tehran Square

By : Jolayemi Olajide Iran don hold big send-off ceremony on Wednesday for dia national football team as dem dey prepare go play for 2026 World Cup wey go happen for USA, Mexico and Canada. Players wear red and black tracksuit as plenty fans gather for Enghelab Square for Tehran dey cheer dem, while coach Amir Ghalenoei and football federation president Mehdi Taj join the event. According to Taj, the […]

todayMay 14, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds