By: Kofoworola Olayinka
Resident doctors for LAUTECH Teaching Hospital, Ogbomoso, don threaten to resume strike on August 28 if dem demand no dey settled.
Di doctor issue di warning on Thursday through statement wey dia leader, Dr. Adedapo Mustapha and Dr. John Stephen, sign.
Dem suspend di strike on June 27 and give management eight weeks to address dia welfare concern.
Di association say dem suspend di action in good faith to protect industrial peace and avoid disruption of healthcare service.