Sports

529 Results / Page 1 of 59

Background

Sports

Crystal Palace Carry Head Enter Conference League Last 16

By: Esther Ayoola Crystal Palace don show beta character enter UEFA Conference League last 16, beating Zrinjski Mostar 2-0 for Selhurst Park. For first leg, dem draw 1-1 with di Bosnian team. Maxence Lacroix and Evann Guessand ni score di goals wey carry dem through. According to report, Dis win sef, dey timely, as e hellep to relieve pressure for coach Oliver Glasner, wey don tuk say e go leave […]

todayFebruary 27, 2026 9

Sports

Arthur Okonkwo Get Clearance To Play For Super Eagles

By: Esther Ayoola Wrexham goalkeeper Arthur Okonkwo don get clearance from FIFA to play for Naija. According to report, di 24-year-old fit now join Super Eagles for di March international window tournament wey go shelle for Amman, Jordan. Na Iran dem go play first on March 27, den Jordan four days later for Amman International Stadium. Okonkwo clearance dey land just as first-choice goalkeeper Stanley Nwabali waka comot im club […]

todayFebruary 27, 2026 4

Sports

Super Eagles Coach Chelle Explain Why Im Ask For $130k Salary

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Éric Chelle, don defend why e dey ask Naija Football Federation (NFF) for $130,000 pay raise. Right now, him dey collect $50,000 per month, however, Chelle dey say di $130,000 no be just for him own pocket, e go also help pay him five-man technical staff, including assistant coach, physical trainer, goalkeeper coach, and personal assistant. E sti say today players dey need special […]

todayFebruary 27, 2026 8

Sports

Osimhen Nor Too Happy With Galatasaray Win Over Juventus

Super Eagles striker Victor Osimhen talk say e no sweet am di way Galatasaray play, even though dem still knock Juventus comot for UEFA Champions League play-off on Wednesday. Galatasaray manage crawl enter Round of 16 with 7-5 aggregate win afta extra-time battle for Turin, despite say Juventus nearly turn di tie upside down. Osimhen drag one goal back when Juve bin don lead 3-0, push di aggregate to 6-5, […]

todayFebruary 26, 2026 4

Sports

D’Tigress Drop Provisional Squad for Women’s World Cup Qualifiers

Nigeria seven-time African champions, D’Tigress, don announce dia provisional squad for FIBA Women’s Basketball World Cup Qualifying Tournament wey go hold for Lyon, France from 11–17 March 2026. Coach Rena Wakama pick mix of experience players and new talents wey go face France, Germany, South Korea, Colombia and Philippines. Big names like Amy Okonkwo, Sarah Ogoke, Promise Amukamara and Ezinne Kalu dey lead di team, plus young guns like Pius […]

todayFebruary 26, 2026 5

Sports

Mbappe To Miss Benfica Game Due To Knee Problem

By: Esther Ayoola Real Madrid striker Kylian Mbappe nor go play against Benfica for today Champions League match say im get knee wunjury. According to report im don dey manage di pain since but for tonight waka for Santiago Bernabeu against Benfica, say im go rest. Madrid get 1-0 advantage from di first leg for Lisbon wey Vinicius Junior suffer racial abuse. Even with im knee problem, Mbappe still dey […]

todayFebruary 25, 2026 3

Sports

UCL: Sorloth Hat-Trick, Lookman Assist, Atletico Hammer Brugge 4-1

By: Esther Ayoola Super eagles striker Ademola Lookman shine wetin nor good as e come from bench hellep Atletico Madrid win Club Brugge 4-1. Alexander Sorloth ni lead di attack, score three correct goals wey make Atletico qualify for di UCL Round of 16. Di match start shakily as Brugge player, Hugo Vetlesen, nearly score, but David Hancko block am. As Atletico settle down, Na so, Jan Oblak pass long […]

todayFebruary 25, 2026

Sports

Naija Sport Senior Man, Egbe Cry For Help Say NPFL Dey Crumble

By: Esther Ayoola Oga CEO of Sports Facilities Construction Limited, Ebi Egbe, don raise alarm say NPFL need emergency help. Say di league dey go ground every day following recent ranking by IFFHS say, di Naija league don fall enter 91st for world ranking. Reacting to di post for X, Egbe say na because say, football ground don kpafuka finish, no good pitch, ni make we nor dey see good […]

todayFebruary 25, 2026 1

Sports

Enyimba News Coachie Deutsch Share Hope Say Enyimba Go Return To Glory Days

By: Esther Ayoola Enyimba new head coach, Emmanuel Deutsch, don promise say di People’s Elephant go soon come back to dia glory days. E tuk dis one afta dia 1-1 draw with Rivers United for NPFL Matchday 27 match wey dem play for Port Harcourt on Sunday. Enyimba ni score first through Abiodun Joseph header before Okon Aniekeme equalise before half-time. Deutsch say, e dey proud of di players’ fighting […]

todayFebruary 24, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app