Sports

443 Results / Page 1 of 50

Background

Sports

FG Ginger Super Eagles Ahead Big AFCON Semi-Final Clash With Morocco

By: Esther Ayoola Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, ni go ginger wi Super Eagles, say make dem stay focused and confident as dem prepare to face Morocco for AFCON semi-final by 9pm. For statement wey e post for im X handle on Wednesday, di minister encourage di team and assure dem say Nigerians for home and abroad dey fully behind dem. Idris tuk say di whole country […]

todayJanuary 14, 2026 4 37 7

Sports

Olusoji Fasuba Pikin, Annabelle, Run Hot Race For England

By: Esther Ayoola Former Nigerian sprinter Olusoji Fasuba pikin, Annabelle Fasuba, don start her U-17 career for England with full force. She win di South of England Indoor 60m title for Lee Valley Athletics Centre, London on Saturday. Di 14-year-old clock 7.51s, just one millisecond short of her club record wey she set for her first race dis season. She don already break U-17 and U-20 club records with 7.50s […]

todayJanuary 14, 2026 3 4

Sports

Ghana Referee Laryea To Run Morocco Vs Naija Semi-Final Match

By: Esther Ayoola Ghana referee Daniel Laryea don get di big job to control di 2025 Africa Cup of Nations semi-final game between Morocco against Naija. CAF put for dia website say, di big match go sup today for Prince Moulay Abdellah Stadium for Rabat by 9pm , and Laryea go dey in charge. Before now, im don only referee one game for group stage when Burkina Faso lose 1-0 […]

todayJanuary 14, 2026 6

Sports

Naija Set For Davis Cup Clash Against Uzbekistan For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Say now, all don set for Davis Cup, di ogbonge table tennis World Group II match, wey go shelle between Naija and Uzbekistan for Lagos from February 7–8, 2026. Organisers say dem don ready for everything, from technical to security and logistics. Oga Presido of Naija Tennis Federation, Victor Ochei, wey tori pipo touchlight im frequency on Tuesday, say dis show say, Naija dey shine for international […]

todayJanuary 14, 2026 3 4

Sports

Mbappe No Dey Training As Arbeloa Take Charge For Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Striker Kylian Mbappe no show for Real Madrid training on Tuesday in Spain as new coach Alvaro Arbeloa take charge for im first session. Arbeloa, wey replace Xabi Alonso on Monday, go lead im first game against Albacete for Copa del Rey on Wednesday, but Mbappe fit no feature. Mbappe just return from knee sprain as late substitute for Spanish Super Cup final wey Real Madrid lose […]

todayJanuary 13, 2026 6 6

Sports

CAF To Arrange Draw For 2027 AFCON Qualifiers

By: Esther Ayoola Di Confederation of African Football (CAF) go do draw for di preliminary round of di 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) qualifiers on Tuesday evening, wey go officially start di journey to di tournament. CAF on Monday don release di official pots for di teams wey go play for di preliminary stage. Pot 1 get Lesotho, Burundi, Ethiopia, Eswatini, South Sudan and Mauritius. Pot 2 get Chad, […]

todayJanuary 13, 2026 9 3

Sports

Dan Evans, Oda Brit Tennis Players Chop Defeat For Australian Open

By: Rilwan Agbomeji Great Britain tennis player, Dan Evans go fall hand for Australia, fail to reach Australian Open main draw. Im go lose inside first round for qualifying phase wey sup for Melbourne. Na so im service weak like dodo, lose 6-1, 6-2 to Japan player Rei Sakamoto. Oda Britons, Jay Clarke and Jack Pinnington Jones, also lose straight sets, and Oliver Crawford lose 6-3, 2-6, 6-3 to Spain […]

todayJanuary 13, 2026 7 3

Sports

Carrick Dey Lead Di Race To Take Over Man United As Caretaker Coach

By: Esther Ayoola Michael Carrick don turn favourite to take over as Manchester United caretaker coach, as people wey close to di club tuk am. According to transfer expert, United bosses wan choose person before players resume training on Wednesday, and discussion don reach final stages with Carrick. Di 44-year-old  don bin do di work  before back in 2021 after Ole Gunnar Solskjaer sack, and e win two matches draw […]

todayJanuary 12, 2026 6

Sports

El Clasico Final: Barcelona Conquer Real Madrid 3-2

By Ebi Oboko Barcelona don go beat  Real Madrid 3-2 for El Clasico for Spain Super Cup final for Saudi Arabia, ni dem run dis one. Raphinha shine shine bobo, score two goals for  di Catalan side. Barcelona  wey dey top La Liga  qualify for di final afta dem hammer Real Betis 5-0 for semifinal. Real Madrid beat Atletico 2-1 for di second semifinal before dis final. Last year, Barcelona […]

todayJanuary 12, 2026 8 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app