Sports

531 Results / Page 13 of 59

Background

Sports

Gary O’Neil Be New Strasbourg Coach

By: Esther Ayoola French club Strasbourg don announce on Wednesday say Gary O’Neil go replace Liam Rosenior as dia new coach. Rosenior leave di Ligue 1 team on Tuesday to join Premier League side Chelsea. O’Neil, wey 42 years old, don play for clubs like Portsmouth and Middlesbrough and even represent England under-21s. For official statement, O’Neil tuk say e dey excited and proud to join Strasbourg, and e dey […]

todayJanuary 7, 2026 10 3

Sports

Super Eagles Buy Waka Marrakesh For AFCON Quarterfinal

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation don confamate say Super Eagles go comot Fez go Marrakesh on Thursday as dem dey prepare for Africa Cup of Nations quarterfinal. Dem go face Algeria for match on Saturday by 5pm. According NFF post on X, say All 26 available players join training on Tuesday evening for Sardienne Complex. Defender Ryan Alebiosu still dey sidelined as e dey recover from injury.

todayJanuary 7, 2026 5 2

Sports

NFF Calm Fear Say Fight Nor Dey Eagles AFCON Camp

By Ebi Oboko Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch. The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each. Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman […]

todayJanuary 7, 2026 8 1

Sports

West Ham Striker Callum Wilson Open Touchlight Dey Find New Club

By: Esther Ayoola West Ham striker Callum Wilson don near agreement to end im contract early. Sources confamate say tuks don almost finish. Di 33-year-old join di club last summer for free and don score four goals in 18 games. New strikers Pablo Felipe and Taty Castellanos mean him chances to play first team go reduce.

todayJanuary 6, 2026 8

Sports

Lookman Post Photo With Osimhen, Clear Fans Mind

By: Esther Ayoola Super Eagles striker player Ademola Lookman, don clear di air on di mata wey hapun for field between im and Victor Osimhen. Say nor issues ooooh. Lookman share photo wey him take with Victor Osimhen and Bruno Onyemaechi for pitch afta Nigeria beat Mozambique for AFCON round of 16 on Monday. Him post am for Instagram on Tuesday with di caption, “Together Always.” Di post come afta […]

todayJanuary 6, 2026 9

Sports

Eddie Howe Dismis Tuk Say Im Wan Go Manchester United

By: Esther Ayoola Newcastle United manager Eddie Howe don make am clear say Man united job nor dey im eyes, because e dey very happy for him job. Howe don dey manage Newcastle since November 2021, and na one of di longest-serving managers for Premier League now. Even though some top pipo like di sporting director and chief executive don change, Howe don build strong relationship with di new bosses. […]

todayJanuary 6, 2026 9

Sports

Chelsea Carry Liam Rosenior E As New Head Coach

By: Esther Ayoola Chelsea don carry Liam Rosenior to con be dia new men head coach, say dem wan build strong team and return to top football. Di Club confamate dis report for dia official website, say Rosenior sign contract wey go run reach 2032, afta e do well for France with Strasbourg and carry dem enter Europe for first time in 19 years. Chelsea tuk say Rosenoir show beta […]

todayJanuary 6, 2026 9

Sports

Anthony Joshua Dey Consider Quit Boxing

By Ebi Oboko Former world heavyweight champion Anthony Joshua say, like dis, dey plan to quit or to continue boxing. According to im uncle, Adedamola Joshua wey conversate dis marra give tori pipo, say, after di tragic car accident for Nigeria wey kill two of im close friends, Joshua tell im family say e wan stop while people still dey greet am. Di uncle tuk say di family sef dey […]

todayJanuary 6, 2026 19 3

Sports

Super Eagles Mash Mozambique 4-0, Enter AFCON 2025 Quarterfinals

By Ebi Oboko Nigeria show beta character hammer Mozambique 4-kondo for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16 for Fez, Morocco, comot for quarterfinals. Ademola Lookman score first goal for 20th minute come still assist Victor Osimhen make e double the lead. Osimhen score again for second half, before Akor Adams finish quick counter make am  4-0. Super Eagles dey ginger for their chase of fourth AFCON title as […]

todayJanuary 6, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app