Sports

672 Results / Page 12 of 75

Background

Sports

Salah To Miss Brighton Match Sake Of Muscle Wunjury

Say Mohamed Salah no go play for Liverpool match wey dem get for Brighton on Saturday because im get muscle wahala. Di Egyptian forward comot pitch on Wednesday after im score for Liverpool 4-0 win against Galatasaray wey make dem reach Champions League quarter-final. Manager Arne Slot talk dis tuk for press briefing dat dem get international break, and Egypt nor go happy as im no fit join dem.  

todayMarch 21, 2026 5

Sports

Lionel Messi Hit 900 Career Goals, Join Cristiano Ronaldo For Football History

By: Esther Ayoola Lionel Messi don score him 900th career goal on Wednesday, join Cristiano Ronaldo as di only players wey reach dat level for top men football. Di 38-year-old Argentina World Cup winner score the goal with him left leg as Inter Miami play 1-1 draw with Nashville SC for CONCACAF Champions Cup. Dis 900th goal come 21 years afta Messi score him first senior goal for FC Barcelona […]

todayMarch 20, 2026 8

Sports

Guinea Tell CAF To Recheck 1976 AFCON Say Morocco Sef Do Walkout

By: Esther Ayoola Guinea Football Federation don ask CAF make dem check di 1976 AFCON wahala, because Morocco waka comot for pitch like Senegal do am for 2025. For dat 1976 match, Guinea bin dey win first, but Morocco  come  equalise last minute afta plenty gbagbos, making Moroco di Champions. Guinea say if dem fit cause say, Senegal do wahala, reverse 2025 result, make dem use same rule for di […]

todayMarch 20, 2026 8

Sports

Anthony Joshua Return To Full Training Afta Lagos-Ibadan Car Crash

By: Esther Ayoola Say like dis, Anthony Joshua don start full training again as e dey prepare for him summer comeback, join di team wey dey train Oleksandr Usyk. Di British-Nigerian boxer last fight na December 19, wen e stop Jake Paul for six rounds for Miami. But days later, him life scatter small, as e waka enter big car crash for Lagos-Ibadan Expressway wey kill him padi dem, trainer […]

todayMarch 19, 2026 4

Sports

Lookman Assist Make Atlético Madrid Beat Spurs 7-5 For UCL

By: Esther Ayoola Ademola Lookman give assist as Atlético Madrid qualify for UEFA Champions League quater finals, even though dem lose 3-2 to Tottenham Hotspur for di second leg. Lookman collect ball for counter, cut small for box corner, then pass am to Julian Alvarez wey score make e 1-1. Tottenham first goal na from Randal Kolo Muani, then Xavi Simons score two, one na penalty. Atlético second goal come […]

todayMarch 19, 2026 7

Sports

NFF Dey Drag FIFA Go Appeal Over DR Congo Player Wahala

Nigeria Football Federation don start process to appeal decision wey FIFA disciplinary committee give about dia protest against DR Congo. Dem bin lose di play-off final 4-3 on penalties for Morocco, but later complain say some DR Congo players no suppose play because of how dem take get passport. FIFA committee don reject di protest after many months, say dem no see enough reason to punish DR Congo. Now NFF […]

todayMarch 18, 2026 7

Sports

D’Tigress Lose Last Game To Germany 81–73 For FIBA Qualifiers

Nigeria women basketball team, D’Tigress, don end dia campaign for 2026 FIBA Women’s World Cup Qualifying Tournament with 73–81 loss to Germany for Villeurbanne, France. Germany control di game from start to finish, lead for every quarter and take charge for more than 33 minutes before dem pull clear for last quarter. Nigeria try fight back for second quarter, turn six-point deficit to 31–27 lead with one 10-0 run, as […]

todayMarch 18, 2026 7

Sports

Arsenal Enter Quarter Final As Chelsea Crash Out For Champions League Battle

By: Esther Ayoola Arsenal show strong hand as dem beat Bayer Leverkusen 2-0 to enter quarter-final of UEFA Champions League. Di North London club carry di tie 3-1 on aggregate afta ogbonge  performance for both legs. Eberechi Eze na im open scoring with Korrect fine goal before halftime. Later, Declan Rice add another goal for second half to seal di win. For Chelsea FC side, dem crash out afta Paris […]

todayMarch 18, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app