Sports

672 Results / Page 11 of 75

Background

Sports

Fans Drag FIFA Go EU Court Over Crazy 2026 World Cup Ticket Price

By: Esther Ayoola Football Supporters Europe (FSE) and Euroconsumers don file case on Tuesday give European Commission against FIFA over high ticket price for 2026 World Cup. Dem tuk say ticket for di tournament wey go happen June 11 to July 19 for US, Canada and Mexico too cost, and accuse FIFA say dem dey use monopoly power control sales. FSE say FIFA impose unfair and confusing buying conditions for […]

todayMarch 24, 2026 6

Sports

Victor Osimhen Chop Knife For Im Broken Arm

Victor Osimhen don successfully do surgery for im right hand wey break during di away match against Liverpool for UEFA Champions League Round of 16. Galatasaray announce on Monday say di surgery hapun for Maslak Acıbadem Hospital for Istanbul, and di club doctor, Op. Dr. Yener İnce, na im perform di surgery. Di Turkish champions wish Victor quick recovery and hope say e go fit return to di field soon. […]

todayMarch 24, 2026 6 2

Sports

No Write Note Giv Chelsea Players – Emmanuel Petit

France legend Emmanuel Petit don clear Chelsea manager Liam Rosenior to stop passing note to players. Petit tuk dis one during im chat with Talksport, after Chelsea lose 3-0 to Everton for Premier League. E tuk say Rosenior dey shame imself with di paper, because players no be children, dem no need all dis kind writing. Petit explain say whenever Rosenior try show substitution note to players wey dey come […]

todayMarch 24, 2026 6

Sports

Nasarawa United Tear Rivers United 4-1 For Lafia Stadium

Rivers United don enter anoda wahala for dia title chase  lossing 4-1 to Nasarawa United for Lafia City Stadium on Monday. Coach Finidi George bin tuk say dem go like return back to di top of di table after Rangers win 2-0 on Sunday, but Nasarawa quick goals spoil dia plan. Ngei Oluka-Efor and Abubakar Abdullahi quick quick score two goals for Nasarawa, while Chimezie Victor add another, before Taiwo […]

todayMarch 24, 2026 6

Sports

Nigeria Shock Ghana, Win By 136 Runs For Patricia Kambarami Cup

Nigeria carry better all-round play beat Ghana by 136 runs for di Patricia Kambarami Cup wey dey happen for Lagos. Naija captain Piety Luck and Victory Igbinedion na im wan finish Ghana, make 44 runs for three overs, while Christabel Chukwuonye carry di innings go reach 159 for four. For Ghana side, matter scatter as dem lose five wickets for only 13 runs early, never fit recover. Nigeria bowler Peace […]

todayMarch 23, 2026 8 2

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance […]

todayMarch 23, 2026 7

Sports

Lookman Score Historic Goal, But Real Madrid Still Shock Atletico 3-2

Ademola Lookman don make history as e become first Nigerian wey score for Madrid derby, but e goal no sti hellep as 10-man Real Madrid turn game around to win 3-2 against Atletico Madrid for La Liga on Sunday. Lookman don score two goals dis season for im debut campaign in Spanish top flight. Di win give Real Madrid (69 points) reduce Barcelona (73 points) lead to just four points […]

todayMarch 23, 2026 4

Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final. Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium. Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble. Four minutes later, O’Reilly […]

todayMarch 23, 2026 5

Sports

Former Super Eagles Player No Gree Make I Enter Iheanacho Room – Osimhen

Galatasaray Striker, Victor Osimhen don yarn how one senior player for Nigeria national football team pursue am comot for room during im first call-up for 2017 under coach Gernot Rohr. Osimhen tok dis one during one livestream chat with Carter Efe on Saturday morning. According to am, di player bin dey share room with Kelechi Iheanacho. E remember say as e come Uyo, I meet Iheanacho tell am say I […]

todayMarch 21, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app