Sports

531 Results / Page 15 of 59

Background

Sports

Venus Williams Come Back Australian Open At Age 45

By: Rilwan Agbomeji Seven-time Grand Slam champion Venus Williams don get wildcard to play Australian Open at age 45, and tournament organizers talk say she go be di oldest woman wey ever play di competition. She still tuk say Australia give her many good memories and she thankful for di chance to come back to a place wey mean plenty to her tennis career. Officials confirm say Williams go break […]

todayJanuary 2, 2026 9 3

Sports

Tobi Amusan, Naija Athletes Shine for 2025 World Athletics Rankings

By Ebi Oboko Beta start for Tobi Amusan as she begin di new year as one of di top-three for World Athletics ranking for 2025 season. She join two oda Naija athletes – Ezekiel Nathaniel and Chukwuebuka Enekwechi – wey sti dey top 100 for world. Tobi wey be hurdling queen collect silver medal for 100m hurdles for Tokyo 2025 World Athletics Championships. She gather 1,430 ranking points, just dey […]

todayJanuary 2, 2026 10 9

Sports

Adebayor: AFCON Don Grow with Stronger fighting Spirit

By Ebi Oboko Former Togo striker Emmanuel Adebayor tuk say Africa Cup of Nations don change now, say now, e don dey more comeptitive. Adebayor wey play for AFCON back in the day talk say the tournament no be just football match again. E yan dis one give CAF online, in those day, e dey more raw and simple, but passion still dey strong. Now e don change well well, […]

todayJanuary 2, 2026 11 12

Sports

EPL Result For New Year Day, Draw Full Ground

By Ebi Oboko Thursday for English Premier League, plenty teams no fit score as draw plenty. Brentford vs Spurs, Liverpool vs Leeds  match end 0-0, while Sunderland hold Man City 0-0. Crystal Palace and Fulham share point after 1-1 draw, same time Chelsea draw 2-2 with Bournemouth. Arsenal beat Aston Villa 4-1, and Newcastle waka pass Burnley 3-1. West Ham and Brighton end 2-2, Manchester United and Wolves draw 1-1, […]

todayJanuary 2, 2026 14 9

Sports

AFCON Wahala: Gabon Ban Aubameyang, Manga, Suspend National Team

By Ebi Oboko Gabon sports minister don ban veteran players Pierre-Emerick Aubameyang and Bruno Ecuele Manga, suspend the whole national team, and sack the coaching staff after dem shameful AFCON performance. Dem lose 3-2 to Ivory Coast because Bazoumana Toure score injury-time winner. Gabon con finish last for Group F after dem lose all three matches, even pass Mozambique. Minister Simplice-Desire Mamboula talk say government no go allow Panthers play […]

todayJanuary 1, 2026 19

Sports

Chelsea Fc sharpaly turn Maresca to EX

By Ebi Oboko Chelsea Football Club don announce say dem and dia  head coach Enzo Maresca don agree to part ways on Thursday. During him time, Maresca lead Chelsea win UEFA Conference League and FIFA Club World Cup. Club tuk say di decision follow dia ongoing plans and ambitions for the team. Chelsea thank Maresca for im contribution and say im achievements go remain important part of the club history.

todayJanuary 1, 2026 11 4

Sports

Super Eagles Go Jam Mozambique on Monday for Round of 16

By Ebi Oboko Unto updates for AFCON, Nigeria super eagles go face Mozambique for round of 16 of the 2025 Africa Cup of Nations after group stage end on Wednesday. Super Eagles get their knockout opponent after final matches for Groups E and F round up the first stage of the tournament. Algeria top Group E with full points after dem beat Equatorial Guinea 3–1, while Burkina Faso finish second […]

todayJanuary 1, 2026 25 1

Sports

Ryan Alebiosu Collect Wunjuri Afta Super Eagles Debut

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles player, Ryan Alebiosu, go dey sideline for one month afta e suffer serious injury for im debut game against Uganda for AFCON 2025 Group C. Alebiosu start di game as Super Eagles win 3-1. Di Blackburn Rovers star wunjuri  happen when Uganda player push am enter advertising board for first half. Even though im dey down small time, Alebiosu still finish di full 90 minutes, […]

todayDecember 31, 2025 8

Sports

Barau FC Comot Ladan Bosso From Work

By: Rilwan Agbomeji Nigeria Premier Football League (NPFL) team, Barau FC, don part ways with dia Technical Adviser, Ladan Bosso. Di club tell tori pipo say Bosso gree step aside afta dem review di team performance for di first stanza of di 2025/26 season. Assistant coach go take over for now as dem prepare for second stanza. Barau FC thank Bosso for im work and wish am better luck for […]

todayDecember 31, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app