Sports

805 Results / Page 13 of 90

Background

Sports

Guardiola Insist Say No Excuse for City Title Race

Manchester City coachie, Pep Guardiola on Friday dey insist say dem nor go give any tight schedule as excuse if dem fail win Premier League title. E tuk dis one for pre match conference ahead Man city weekend game. City dey second for table, three points behind Arsenal, as season dey enter final stage for England. Di club get three matches in seven days from May 13 to May 19 […]

todayMay 1, 2026 16

Sports

Team Nigeria Get Setback Say Chukwuma, Ogundiran Fit Miss World Relays

Team Nigeria don get serious setback as two US-based sprinters, Rosemary Chukwuma and Blessing Ogundiran, fit miss World Relays 2026. Di Competition go hold for May 2 to May 3 for Botswana National Stadium, Gaborone, but both athletes never join di Nigerian team till now. Chukwuma delay na because of her passport wey come late from embassy. For Ogundiran side, she still dey wait for result of her SRY gene […]

todayMay 1, 2026 13

Sports

Former Super Eagles B Midfielder Explain Why Players Dey Japa Go Anyhow Countries

Former Super Eagles B midfielder Ifeanyi Ifeanyi don scata mouth say Nigeria premier football league dem nor dey pay well, na im make players dey take risk go countries wey nobody sabi E tuk dis one for interview with journalist, as im dey explain how life be for am since e move go play football for Iraq. According to am, di reason why people dey fear na because nobody really […]

todayMay 1, 2026 13

Sports

Mikel Reject Fabregas as Chelsea Boss Option

John Obi Mikel tuk one bombshell say Cesc FĂ bregas no suppose collect Chelsea manager job, at least for now, say e still too early. E tuk dis one for im Obi One Podcast, as e praise di work wey FĂ bregas dey do for Como but insist say make e gather more experience first. Instead, Mikel carry hand point Filipe LuĂ­s as beta option for di Chelsea job, say na im […]

todayMay 1, 2026 10

Sports

Palace Hammer Shakhtar 3-1 For Semi-Final First Leg

Crystal Palace don scatta Shakhtar Donetsk 3-1 for UEFA Conference League semi-final first leg wey hapun for Krakow, Poland. Ismaila Sarr, Daichi Kamada, plus Jorgen Strand Larsen na im be di people wey score di goals wey give Palace di advantage. Even though Shakhtar dey try for Europe despite all di wahala from war, dem still nor fit match Palace strength

todayMay 1, 2026 12

Sports

Mainoo Sign New Man United Deal Till 2031

Kobbie Mainoo don sign new contract with Manchester United wey go keep am for club till 2031. Di 21-year-old midfielder wey join di academy since 2014 don already play 98 matches, even score di winning goal for 2024 FA Cup final and represent England for Euro 2024 final. Mainoo talk say Manchester United na im home and di club mean everything to im and im family. E still add say […]

todayApril 30, 2026 18

Sports

Mainoo Sign New Man United Deal Till 2031

By: Esther Ayoola Kobbie Mainoo don sign new contract with Manchester United wey go keep am for club till 2031. Di 21-year-old midfielder wey join di academy since 2014 don already play 98 matches, even score di winning goal for 2024 FA Cup final and represent England for Euro 2024 final. Mainoo talk say Manchester United na im home and di club mean everything to im and im family. E […]

todayApril 30, 2026 14

Sports

Arsenal Late Penalty Drama Scatter Match as Atletico Force 1-1 Draw for UCL Semi-Final

By: Esther Ayoola Arsenal and Atletico Madrid don go play draw 1-1 for dia Champions League semi-final first leg. Referee first award late penalty for Arsenal afta Eberechi Eze fall, but VAR check cancel am say no serious contact. Before dat, Viktor Gyokeres  score penalty for Arsenal, while Atletico reply through Julian Alvarez penalty afta handball decision. Super Eagles player Ademola Lookman sef play full 90 minutes for Atletico and […]

todayApril 30, 2026 14

Sports

FIFA Show Off New Volunteer Uniform For 2026 World Cup

By: Esther Ayoola FIFA don show di official volunteer uniform wey dia workers go wear for 2026 World Cup wey go happen for USA, Canada and Mexico. Di kit get bold and modern design wey dem create to make am easy to see, comfortable, and practical for volunteers. FIFA put am for dia X handle on Tuesday, say Volunteers go wear different layers wey go match hot or cold weather […]

todayApril 29, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds