Sports

330 Results / Page 23 of 37

Background

Sports

EPL: Dyche Dey Top List for Forest Job After Postecoglou Comot

Nottingham Forest dey for advanced talks to appoint Sean Dyche as dia new head coach after dem sack Ange Postecoglou. BBC Sports report say Dyche don become di main candidate and di club dey hopeful say dem go finalize di deal by Monday. Postecoglou bin comot just 17 minutes after Forest lose 3-0 to Chelsea on Saturday, a defeat wey put di club for 18th place for Premier League after […]

todayOctober 20, 2025 6

Sports

2026 World Cup Qualifiers: We Ready To Face Nigeria – Gabon Head Coach

Gabon head coach Thierry Mouyouma don yan say him boys dey ready to face Nigeria Super Eagles for di African playoffs for 2026 FIFA World Cup. Gabon finish dia qualification campaign with 8 wins, 1 draw and just 1 loss gather 25 points from possible 30. But dat still no reach to top Group F, as Côte d’Ivoire carry 26 points take collect di automatic qualification. Mouyouma talk say e […]

todayOctober 17, 2025 7

Sports

Flamingos Don Finalize Dia Preparation Before U-17 Women’s World Cup Opener Against Canada

As di 2024 FIFA U-17 Women’s World Cup go kick off officially on Friday, Nigeria U-17 women team, Flamingos, don dey finalise dia preparation for dia first Group D match wey go shele on Sunday against Canada. According to wetin BSNSports.com.ng yarn, di girls hold one serious training session on Friday where dem focus on set-piece execution, defence arrangement, midfield transition and general fitness. Di coaching crew also hammer on […]

todayOctober 17, 2025 7

Sports

NPFL Don Slap ₦1 Million Fine On Clubs Over Ball Boys Wey Dey Waste Time

Di Nigeria Premier Football League (NPFL) don warn say any club wey im ball boys dey waste time during match go pay fine of ₦1 million. NPFL Chief Operating Officer, Davidson Owumi, drop dis tori for one circular wey dem send give clubs, say make dem reorient dia ball boys make dem dey promote fair play and respect di game. According to di statement, “Any team wey dey encourage or […]

todayOctober 17, 2025 6

Sports

Four Must-Win Battles Wey Go Carry Naija Enter World Cup

Di Super Eagles of Nigeria still dey chase dia World Cup dream after dem knack Benin Republic 4-0 for Godswill Akpabio Stadium for Uyo. Victor Osimhen score hat-trick and Frank Onyeka add late goal wey make Naija finish second for Group C of di CAF qualifiers. Even though di win sweet, Naija still no qualify straight as South Africa top di group with 18 points after dem beat Rwanda 3-0. […]

todayOctober 16, 2025 6

Sports

Eagles World Cup journey No smooth – Ekong Yarn

Super Eagles skipper, William Troost-Ekong don open up say Nigeria journey to di 2026 FIFA World Cup still long and no easy at all, even though dem don qualify enter di CAF Play-off Tournament wey go happen for Morocco next month. Na after dem knack Benin Republic 4–0 for Uyo on Tuesday give dia best performance so far for di qualifiers. But even with dat kind big win, e no […]

todayOctober 16, 2025 8

Sports

Argentina Knack Colombia 1-0 To Book Final Spot Against Morocco

Argentina and Morocco don qualify reach di final of di 2025 FIFA U-20 World Cup after Argentina narrowly beat Colombia 1–0 for dia semi-final clash on Thursday. Na Mateo Silvetti score di only goal for 74th minute after Gianluca Prestianni tear space for right flank and give am correct assist wey e blast enter from di centre of di box. Di game hot as Colombia later collect red card wey […]

todayOctober 16, 2025 9

Sports

“List Of Nine African Countries Wey Don Qualify For 2026 FIFA World Cup, One Still Dey Hustle For Playoff Spot”

Africa don ready for dia biggest show for FIFA World Cup as nine countries don already qualify for di expanded 2026 tournament wey go happen for Canada, United States and Mexico. Di countries wey don book dia space be: South Africa, Egypt, Ghana, Algeria, Senegal, Morocco, Tunisia, Cape Verde and Ivory Coast (Côte d’Ivoire). Di 2026 edition go get 48 teams, and Africa don collect nine automatic slots – na […]

todayOctober 15, 2025 13

Sports

2026 WCQ: Osimhen Na Di Best Striker For Di World, We Ready For Playoffs — Chelle

Super Eagles head coach Éric Chelle don talk say Victor Osimhen na di best striker for di world after di Galatasaray star carry di team waka win Benin Republic for Uyo on Tuesday. Nigeria knack 4-0 for di 2026 FIFA World Cup qualifying matchday 10. Osimhen score two goals for di first half and still add another one after di break. Chelle come talk say im players be champions, say […]

todayOctober 15, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app