Sports

533 Results / Page 23 of 60

Background

Sports

Why We Scatter Chelsea 3-1 – Leeds Oga Daniel Farke

By: Rilwan Agbomeji Leeds United oga, Daniel Farke yarn say dem jam Chelsea 3-1 Wednesday night because im players really carry fire put show, run dem blues all over for dia house, no gree give dem chance to breathe. Farke dey shine eye as Ao Tanaka, Jaka Bijol, and Dominic Calvert-Lewin burst goals wey scatter Chelsea defense, carry Leeds run riot for Elland Road. We dey mad hungry to carry […]

todayDecember 4, 2025 12

Sports

Make Fulham Forget Man City Beating — Iwobi

By: Rilwan Agbomeji Fulham winger, Alex Iwobi don fire up im boys afta dem loose 5-4 giv Manchester City for dia own house for Tuesday. Fulham Boys no come sell groundnut ooo as dem match City fire-for-fire, push dem sotay e remain small make dem thief one point comot Pep hand. Na Iwobi even light di fire as e tear net with one mad goal afta second half pass small, […]

todayDecember 3, 2025 10

Sports

Salah Go Bounce Enter Egypt Camp Dec 15 – Slot

By Rilwan Agbomeji Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15. Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players. Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on […]

todayDecember 2, 2025 8

Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

By: Rilwan Agbomeji Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come. Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and […]

todayDecember 2, 2025 5

Sports

We Go Block Osimhen Goal – Skriniar

Fenerbahce captain, Milan Skriniar don fire warning shot, talk say dem ready lock Victor Osimhen completely as di Istanbul derby go burst tonight for RAMS Park. Galatasaray dey top table with one point, and dis match don turn full-blown city war as both sides dey ginger for supremacy. On top post for X, Skriniar yarn say Osimhen and Icardi fit be hot strikers, but tonight, Fenerbahce dey come rugged, compact […]

todayDecember 1, 2025 21

Sports

Mikel Obi – “I No Go Allow Corruption Follow Me, I Wan Run NFF”

Former Super Eagles captain, John Obi Mikel, don yarn say e wan take leadership role for Nigeria Football Federation (NFF), but e clear say e go only enter di position if di system clean and no corruption dey. Di 37-year-old football legend talk say Nigeria wey no qualify for FIFA World Cup show say plenty wahala dey inside Nigerian football wey pass di pitch, and e believe say na total […]

todayNovember 28, 2025 23

Sports

EPL – Awoniyi, Aina No Go Play As Nottingham Forest Take On Brighton

Super Eagles duo Ola Aina and Taiwo Awoniyi no go show face as Nottingham Forest battle Brighton on Sunday for Premier League. Awoniyi still dey struggle with knee injury wey make am miss Forest clash with Liverpool last weekend, even after e just return to full training from serious abdominal injury earlier dis year. For Aina matter, manager Sean Dyche don still cast doubt on di defender return, even though […]

todayNovember 28, 2025 9

Sports

“We Gats Focus” — Arokodare Ahead Of Wolves vs Villa Derby

Wolverhampton Wanderers striker Tolu Arokodare don talk say di team gats ready to fight for win as dem face Aston Villa for di West Midlands derby. Wolves don collect only two points from 12 Premier League games dis season, and Rob Edwards’ side dey desperate to grab dia first league win against Villa. Arokodare yarn say even though di match get extra weight as local derby, im wan remove pressure […]

todayNovember 28, 2025 12

Sports

Mbappé Join Cristiano Plus Two More Real Madrid Legends For Special List

Real Madrid don dey suffer small wahala as e dey happen anytime Kylian Mbappé no fit score. After im start di season well, e jam small dry patch wey coincided wit three game wey dem no fit win. Na so pressure start dey build for team, but Mbappé show up for di big match against Olympiacos. After Real Madrid fall behind for Athens, di French star switch things up gbagam, […]

todayNovember 28, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app